Connect with us

Pidgin Corner

12 years old girl suddenly slump and die during school hours

Published

on

12 years old girl suddenly slump and die during school hours

12 years old girl wey him name na Miss. Boluwatife Oladipo, wey dey attend Saint Louis Girls’ Grammar School for Akure, Ondo State, don suddenly slump and die during school hours on October 15, 2024.

According to Ondo tori paper on October 15, di small girl wey die, Miss. Oladipo tell her friends say she beg her mama to born more pikin, but her mama no gree.

Dem say na JSS 3 student she be.

Wetin happen be say, she bin predict her own death before e happen.

Her friends wey witness am talk say, while dem dey play, Miss. Oladipo talk say she feel say she go die.

“Mama no wan born again, and I go soon die.” Na wetin she use her mouth take talk

Small time later, she collapse for ground and dem rush am go school clinic.

Di clinic give her first aid before dem take her go University Medical Teaching Hospital (UNIMETH) for Akure, where doctor declare her dead on arrival.

Na so she slump and die, chai!

Friends and family dey mourn her loss, and dem dey investigate to know wetin really cause am.

One of di teachers dem wey no want make dem mention her name for tori talk say:

“Last Tuesday, classes dey go on for school wen we hear say JSS 3 student don faint.”

“We quickly rush go attend to am,” na di teacher talk na.

“E bin dey very obvious say di small girl wey die know say she go die, based on wetin she do before di incident take happen.”

See also  NELFUND: Tinubu introduces education loan fund for students

“Na so-so sign di girl dey show like say she know say her time don reach, but nobody understand am at all.”

“We come learn say di girl dey play with her friends outside classroom.”

“Wen bell ring for next class, wey be Mathematics, dem all run enta class.”

“After dem enta classroom and Mathematics teacher arrive, she put her head on desk.”

“na so her concerned classmates go meet her, tap her, tell her say teacher don dey classroom already.”

We discover say wen her classmate reach am, she lift her head, tell her friends say she wan die.

“Di classmate dem com alert di teacher, wey rush go meet her,”

Di teacher continue: “By di time teacher reach her, she talk am again, I wan die.”

“Teacher call other teachers, dem rush her go school clinic as she still dey repeat say she wan die.”

“Den dem com rush am go UNIMEDTH. Doctor wey treat her see say her body don turn white like paper, because blood no dey.”

“Dem quickly put her on blood transfusion. But sadly, she die during di process.”

But Ondo State Ministry of Education no talk anything about di matter yet.

According to di source, dem say while some teachers from di school visit di girl house, her mama com make some revelations.

“Di mama of di girl tell dem say e take am years to born her, and she be di first pikin,” one of di teacher talk am.

Di girl don dey pressure her mama to born another pikin.

See also  JERUSALEM -Israel don make new law wey allow dem take deport family members of attackers. Experts say e go fit get struck down. 

“Di mama talk say on one of di fateful morning, she tell her papa say she go travel abroad for her Senior Secondary School education.”

“She come hug her papa and wave goodbye to her mama,”

E also report say di mama disclose say for early hours of di day, she see one figure wey resemble ghost waka pass for di house.

She inform her husband, and dem pray together over am.

“E dey very hard to say goodbuy to you my pikin Oladipo, my womb opener.”

“Di memory no fit leave me like dat” di mama cry out.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

Breaking: Nigeria’s first female fighter pilot makes history in Ghana.

Tragedy: Gunmen kill disabled man and artisan in Imo community

Just in: Lagos port officials watch as cargo ship catches fire

Breaking: Navy uncovers and seizes stolen crude oil in Delta

Okey Bakassi Crowned Traditional Ruler in Imo Community

2027: Atiku’s Aide denies ADA adoption by opposition coalition

Just in: NDLEA chairman, Gen. Buba Marwa, loses mother-in-law

Mysterious Disease breaks out in Imo Community, kill six people

NPA prevents major disaster at Lagos port complex

2027: ADA is a joke, lacks substance to challenge Tinubu — Keyamo

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks