Explosion gbege as pipo dey protest for River State

Share this:

Kasala don burst for River State as Police Oga don withdraw him pipo fo di 23 Local Governments on October 7, 2024, as pipo don enta street on Monday to protest against am.

According for reports, Political agbero dem don enta street bigin dey shoot gun everywhere as di protest dey go on October 7.

Tension still dey Rivers State as at Monday, na so fresh explosions hit di road, and protests begin happen for som local government areas.

READ ALSO:  ICYMI: Confusion as “say no to protest” protest erupts in Nigeria

Na so di Inspector General of Police, Mr. Kayode Egbetokun, give order mek dem open di secretariat of di 23 LGs and withdraw di policemen wey dey there.

Di situation dey serious, and plenty pipo dey worry about wetin go happen next.

Di Rivers State government don try to address di mata, but e still dey tricky.

Som of di local government areas wey dey affected include Abua-Odual, Ahoada East, Ahoada West, Akuku Toru, and Andoni.

Pipo wey dey the state com keep eye on di situation and dey hope say peace go return to Rivers State soon.

READ ALSO:  Over 400 injured as explosion rocks Iran’s port in Abbas

As e be so, protesters don invade Ogba/Egbema/Ndoni LGA council headquarters for Omoku, no allow di newly sworn-in chairman to start work.

Dem no gree mek am resume office, and di situation dey cause tension for di area.

From wetin I hear, na since di newly elected chairmen of di local governments for Rivers State resume work, protesters don begin dey protest, and explosion don happen for som places.

Di Governor, Siminalayi Fubara, don send thugs to set fire to som secretariats, and gunshots don dey heard for som areas.

READ ALSO:  Christmas tree burning: Protests hit Syria

Di mata dey serious, and pipo don dey fear say e fit lead to more violence.

Di protesters dey demand say di headquarters of Ogba/Egbema/Ndoni LGA wey dey for Omoku now make dem bi relocat go mekanoda place.

Dem say na for di safety of di council chairman and make for peace to return to di area.

Share this:
RELATED NEWS

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

- Advertisment -

Latest NEWS

Trending News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks