Pidgin Corner
Why I no dey talk to Bishop Oyedepo again

Di founder and Head Pastor of Citadel Global Community Church, wey dem formerly know as Latter Rain Assembly, Pastor Tunde Bakare, don com dey talk why him bin no dey talk wit Bishop David Oyedepo wey be founder of Living Faith Church Worldwide and pastor for Faith Tabernacle wey dem dey call Winners Chapel, again.
Pastor Bakare na one of di big pastor for Naija wey dey influential and pipo dey respect am well-well/.
Him be trained lawyer and him speak God’s word wit plenty eloquence.
Di man of God get plenty influence, even contest for Presidency unda for one of di presidential runs wey no succeed.
Him na man wey no dey fear to talk truth to pipo, no mata who go dey vex.
Him go talk am as di mata bi, even if na only am hold different view from everybody.”
Pastor Bakare get plenty followers, no bi just inside church, but outside too, because him no dey fear to tell government truth
Anoda tin wey pipo dey appreciate Pastor Bakare for be say him get plenty knowledge of Bible, him sabi scripture well well.
But, Pastor, no dey like am wen anoda pastor dey misinterpret Bible or dey twist am anyhow.
Him no go take am like play-play oo.
Pastor no go fit keep quiet, him go ‘yab’ you well-well, make you for see say you dey carry beta error.
Im don talk on October 9, 2024, say im start for Deeper Life Ministry before him com join Redeemed Christian Church of God, but him no stay dere.
According to di tori wey dey News Band on October 9, im explained why him bin no dey talk wit him former friend.
Dat time wey he and Oyedepo get different mind about Bible teaching.
Na for one conference wey dem both attend na dia dem start to dey argue about Bible.
From dat day, dem relationship no dey same again, e get damage.
Bakare and Oyedepo com quietly go dem separate ways afta dat day; dem no dey attend each oda program again.
Him talk say, before-before, him and Bishop Oyedepo be like brothers, dem dey tight.
Him bi dey do crusade for Ota, na for dat Ota wey him take invite Bishop come Ota dat time, as Bishop neva sabi wia Ota dey before.
Na for dat crusade ground, him invite bishop to com minister for one of dey nights.
“Na God bless Bishop Oyedepo for wetin him don establish for Ota, me neva see am before, but dem say e be great, e fantastic.”
“Since I leave Ota afta dat crusade, I neva dey go dere again, na only one time I go Ota wen Olumide’s mama die, I go dere for burial”
Pastor dey talk say, one day dem bin dey hold seminar for Sheraton Hotel, Abuja.
Say dat morning, “I just dey finish preaching, bishop come later.”
“Bishop Oyedepo com bring plate, pour oil, dey anoint pipo hand, and prophesize say as I dey anoint your hand, na so money go dey follow you”
Mr. Bakare com yarn say, if him no wise up small, him for don get big wahala wit Oyedepo dat day, but dem dey stay same suite, dey pray togeda before dem go preach.
But wen dem reach room, him tell Mr. Oyedepo say, ‘You talk something downstairs wey me no see Bible base am.”
“How oil wey you pour for pesin hand go make money follow dem?'”
Him say na so bishop com tell am say, one day wey Pastor Adeboye preach for am, Adeboye talk say, because of di anointing, when Jezebel die, dog no fit touch her head, hand or foot wey dey anointed.
Na so him com ask bishop, “you dey transfer Jezebel anointing to dem or wetin?”
“But how dis one com take bi foundation for money to follow dem?”
Him com tell Oyedepo say, “me go correct dat mistake wey you don make for next session” but Oyedepo say “no”
Him com tell am say, “me no fit preach if you no go correct dat kind mistake wey you don make”
“I go pack my tings, comot for di hotel” and from dat day till now, dem no dey preach togeda again.
Una dey remember say som years ago, Pastor Bakare blast Bishop Oyedepo say him get private jet.
Pastor Bakare talk for national TV say, him no envy Bishop Oyedepo at all, say him sef don buy jet before but na for business.”
Him yarn say, “One man for London try to yab am for Ben TV, say “Pesin wey I dey interview today no be one of dose pastors wey dey fly jet oo.
him cut am short say, “Hold am dere, before dem, I get Boeing 747, but I dey use am for business.”
“Na cargo company bi dat, no dey talk nonsense. If you no get, no dey condemn pesin wey God bless.”
Him don tear book wey Bishop Oyedepo write, say di book dey full of mistake, especially for where him dey talk about anointing oil.
Him com say “but pipo no know say we don settle our mata.”
“We don make am up, we dey inside plane, wen Pastor Mbanga see us dey chop togeda, him confuse.”
“Me no dey fight pipo, but me go defend di gospel, because gospel na wetin mata pass” na so Pastor talk.
“Me, I no bi perfect oo, but make you show me say wetin you dey do na based on God word.”
“But if you no fit follow God word, den make we go by law and testimony.”
“If dem no talk according to God word, na sign say dem no get light, na simple mata bi dat.”
“If you point out mistake wey I do, I go confess am to world, say I do wrong.”
“We don chop, come down, Oyedepo com tell me say, “My friend, you wound me well-well wen you tear my book.”
Me sef tell am say, “Bishop, you too smart pass dat one na, me no tear your book, na my own book wey you write wey I buy for your han i tear.”
Him yarn say bishop na one of di pipo wey make am stop him TV series, wey dem call “Synagogue of Satan,” wey him dey use take expose some truth.
“We dey Ghana, one big Pastor com ask me if I don talk to Oyedepo about dis thing. Him claim say Oyedepo dey receive special revelation from God, wey be hidden mystery.”
Him com ansa dat Pastor say, “Me Bible don already reveal everyting, no more hidden mystery. Make we just focus on preaching gospel, no more, no less.”
Him still dey close to some men of God, like Pastor Mike Okonkwo, but him don distance himself from many odas big pastore because of Bible principles.
Because say Bishop Mike bi big leader for gospel, him and Dr. Felix Omobude, Pentecostal Fellowship of Nigeria (PFN) President, na two pesin wey I dey look up to.”
“And na only dia two Dr. Omobude and Bishop Mike I contact during Covid lockdown.”
Dr. “Omobude go call me to check on me, I go call Bishop Mike to confirm say him and him wife dey alright.”
“Make you no com dey tink say my connect with Mike Okonkwo no experience wahala, e experience am, but e still stand.”
“Me expect dem to check me well-well if I dey spread error, because we no suppose pollute atmosphere, because e go affect plenty pipo and younger ones too.”
“Him be man wey get large heart, and him no dey stray from Gospel.”
“I no dey talk say dem make mistake, but within our connection, tings fit change, and pesin fit repent and move on.”
“You no get right to dey hold dem to wetin happen long time ago.”
“Plenty tins happen, and I go reveal am all wen I drop my memoir; I go talk about my journey with dem men of God and why we go separate ways.”
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook