Connect with us

Pidgin Corner

African countries wey employed youth dey live below $2.15

Published

on

African countries wey employed youth dey live below $2.15

For some African countries, young workers dey struggle with less than $2.15 a day, na serious sign of the deep economic wahala wey dey across the continent. Madagascar get the highest percentage of employed youth wey dey live on less than $2.15 a day, wey be 78.18%.

* Business Insider Africa show African countries wey employed youth dey live below $2.15.

* Madagascar get the highest percentage of employed youth wey dey live on less than $2.15 a day.

* Burundi follow with 69.67%, and Mozambique dey third with 68.66%.

Africa, na continent wey get plenty natural and human resources, dey face some big economic.

Wahala wey dey affect millions, especially young pipo wey dey struggle to make ends meet, even wen dem get jobs.

As African countries dey try rebuild dia economies, jobs for youth don become more important pass before.

But as more young pipo dey find jobs, plenty still dey live for poverty.

For some African nations, young workers dey manage with less than $2.15 a day, na serious sign of the deep-rooted economic issues wey dey across the continent.

Living for such low wages, young pipo dey face daily wahala just to fit buy the basic things.

Rent, food, healthcare, and education dey often far from dem reach, and dem dey forced to make hard choices just to survive.

Why dis poverty dey continue, even among pipo wey dey work?

Na mix of factors. First, plenty African economies dey stuck for cycle wey dey depend on agriculture and raw materials, wey no dey create enough stable, high-paying jobs.

See also  Africa's 10 Least Visited Countries

Bicos no plenty investment dey for other industries like manufacturing or tech, job opportunities dey limited, and wages dey low.

Anoda big wahala na di fast-growing population. Africa get one of di world’s quickest-growing youth population, with plenty young pipo dey enter di workforce every year.

Although dis fit be big economic advantage, di lack of jobs don cause high unemployment and underemployment.

According to one Statista report wey base on data from di International Labour Organization, Madagascar get di highest percentage of employed youth wey dey live on less than $2.15 a day, at 78.18%. Burundi follow with 69.67%, and Mozambique dey rank third at 68.66%.

Below na di African countries wey employed youth dey live below $2.15:

Rank      Country Percentage

1              Madagascar        78.18%

2              Burundi 69.67%

3              Mozambique     68.66%

4              Malawi 65.66%

5              Central African Rep         65.52%

6              Somalia 59.17%

7              Congo DR             56.91%

8              Yemen  56.79%

9              Zambia 56.11%


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

The Selectorate: When the People Vote But The Judges Choose

OYC begs Soludo: Save igbo language from extinction

Thunderous Whispers: Poet Laureate—Ugorji Explores 2027 Run

Blue marine alliance slams NIWA over 101 waterway deaths in 2025

Peter Obi swears: I’ll serve only four years

UK under gire for role in Kanu’s detention

Gunmen kill real estate official, dump body after chatting wife with his phone

COPDEM set to inaugurate 3,480 Anambra LGA, ward executives in Nnewi mega rally

Nigeria may not survive if APC retains power in 2027 — El-Rufai

Digital Ambush: Inside the APC’s Multibillion Naira Plot to Silence Dissent Before 2027

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks