Connect with us

Pidgin Corner

Di Impact of Mid-Flight Diversions on Sports Teams Super Eagles’ Journey to Libya

Published

on

Pilot

Di Tunisian Pilot wey carry Super Eagles go Libya for dem next match don on October 15, 2024, share details of wetin happen mid-flight, say dem allegedly order by top Libyan authorities make dem change flight destination.

Inside di video wey dey circulate for X (wey dem formerly call Twitter), on October 15, di pilot com describes how, despite planning to land for designated airport, dem instruct am by officials say make him divert to another one just as dem near original destination.

According to di Pilot, him talk say him try to inform di officials plenty-plenty times, infact him try past eight times about di issue, but dem com insist say di command come di from di highest authority and dem must obey.

Him express him concern for players’ safety, say dem even calculate di fuel specific route and destination.

“Di request bin dey unusual, and I need to seek for di clarification before I go fit proceed.” Na so him talk

Dis disclosure follow reports wey suggest say Super Eagles players face mistreatment from Libyan authorities prior to dem match.

Di Pilot statement don com spark widespread attention, wit plenty-plenty reactions flooding inside comments section of di video post.

Even one of di Super Eagles player Mr. Victor Boniface don follow express frustration over poor treatment wey Nigerian national team dey endure for Al Abaq Airport for inside Libya ahead of dem AFCON 2025 qualifier second-leg match.

Dia plane com unexpectedly redirect mid-flight to remote airport, wey dey located about three-hour drive from Benghazi.

See also  Oga Biden no wan mek Israel destroy Iran nuclear program

Di Players com stranded for airport for over 10 hours without basic amenities.

Mr. Boniface, wey dey play for Bayer Leverkusen, com enta him social media take talk him mind how him no dey happy.

Him highlighting di lack of food, Wi-Fi, or proper sleeping arrangements.

Him call on CAF make dem address situation, say “Dem don dey di airport for almost 13 hours, no food, no Wi-Fi, nowhere to sleep. Africa, we fit do beta CAF.”

But di sudden change in plans raised concerns among di flight crew and passengers.

Di Details of di diversion, follow for di alternative location and reasons behind di instruction, and di mata no dey clear at all.

Di Nigerian Football Federation (NFF) neva comment put for inside di mata.

This development raises questions about the safety and security of football teams traveling to Libya for international matches.

Dem (NFF) don promised to investigate di incident and ensure di safety of di Super Eagles.

“We take di safety and well-being of our players and officials very seriously,” na NFF spokesperson talk dis one.

“We go look inside di mata and take necessary steps to take prevent di same incidents for future.”

Di Confederation of African Football (CAF) don follow dey aware of di incident and people don dey expected dem to release statement shortly.

Di players safety dey very important and dis can incidents get far-reaching implications for di sport.

As investigations dey go on, fans and stakeholders don dey wait for answers to know wetin led to dis unusual diversion and measures to take prevent similar incidents for future.

See also  Man, don find out say di pastor wey marry am na di papa of him two pikin dem

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

President Tinubu’s top aide resigns

Powerful 6.3-magnitude earthquake rocks Bogota, Colombia

VIDEO: Trump stumbles on air force, internet explodes with mockery

PHOTO: You are forgiven, Tinubu tells Lagos gov Sanwo-Olu

Brazil’s ex-president Bolsonaro, stands trial over involvement in coup plot

2027: Tinubu’s endorsement by APC govs won’t give him victory — Ndume

Enraged LA protesters flood the streets, say they are not afraid of Trump

JUST IN: China introduces pain-free childbirth to boost population

More Senators desert LP as Edo lawmaker defects to APC

Trump’s travel ban takes effect: 12 countries face entry restrictions

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks