Connect with us

Pidgin Corner

Dis na stupid idea Donald Trump tell Joe Biden

Published

on

Dis na stupid idea Donald Trump tell Joe Biden

Di President-elect Donald Trump don on Monday talk say him go fit reverse former President Joe Biden’s recent decision wey him take allow Ukraine forces to make use of American long-range weapons to fire deeper into Russian territory.

Na so him com take call di decision wey Biden make last month “stupid.” E also com vex say dem no consult him incoming administration before Biden make di stupid move.

With di kind loosening of di restrictions, Biden com give Ukraine permission to make use of di Army Tactical Missile System wey di U.S. provide to take fire Russian positions hundreds miles from its border.

“I no tink say dem suppose allow am, no be wen di possibility dey certainly say e neva even reach few weeks before I take over office.”

“Why dem go do dat without say dem no ask me wetin I tink? I no go allow am do dat. I tink say e be big mistake.” Trump talk during wide-ranging news conference for him Mar-a-Lago resort.

Trump’s weak criticism of di Biden administration’s move com as di Democratic administration dey aim to push every last dollar wey dem don appoint for dat purpose for Ukraine out of di door to take help push back Russia’s invasion before Trump take office on Jan. 20, with future aid uncertain.

But even as Biden dey try to surge weaponry and oda said to Ukraine for him final five weeks for office, di moment him emphasize say na Trump dey hold di most significant influence over how Ukraine fit use its U.S.-provided arsenal in di long run.

See also  Biden battles with 'aggressive form' of prostate cancer

Dis na di very serious piece of use di opportunity wey e fit use to take try to follow through for him campaign pledge to take bring about di end to di palava fast-fast.

Wen dem ask am if him go consider to reverse di Biden administration decision, Trump respond: “I fit. I tink say na be very stupid tin wey him do.”

Di White House push back for Trump’s criticism, noting say di decision dey made afta months of discussion wey start before last month’s election.

“All I fit assure you be say for di conversations wey we don get with dem since di election, and we don get for different levels, we don articulate to dem di logic behind am, di tinking behind am, why we dey do am.”

White House national security spokesperson John Kirby talk about di current administration’s coordination with di outgoing administration.

Trump’s relationship with Russian leader Vladimir Putin don dey inspect very closely and carefully since him 2016 campaign for president, wen e call on Russia to find and make public missing emails wey Hillary Clinton, him Democratic opponent, delete.

Trump publicly side with Putin over U.S. intelligence officials whether Russia don interfere for di 2016 election to take help am, and Trump don praise di Russian leader and even call am “pretty smart” for invading Ukraine.

Vice President-elect JD Vance don talk say while di U.S. get differences with Russia, but e dey counterproductive to approach Moscow as enemy.

Trump on Monday don reiterate him call for both Ukrainian President Volodymyr Zelenskyy and Russian President Vladimir Putin to take negotiate di end of di war, as e dey call di death and despair wey di conflict don cause “massive destruction and killing.”

See also  Joe Biden, in first public statement after cancer diagnosis, thanks all for support

But Trump don also appear to acknowledge say finding immediate endgame to di war some tin wey e don previously talk say e fit do within 24 hours of taking office fit dey difficult.

“I tink di Middle East go dey in good place,” Trump talk dis one as him dey refer to di wahala for Gaza and unsettled Syria following di ouster of Bashar al-Assad.”

“I actually tink e go dey more difficult to end di Russia-Ukraine situation.”

Trump don denied say him no talk whether e don speak with Putin since di election.

Zelenskyy meet with Trump for Paris earlier dis month, while di president-elect dey visit France for di reopening of di Notre Dame Cathedral.

Zelenskyy and oda Ukrainian officials don dey make forceful effort to take make Trump to maintain support for Ukraine.

But di situation for di ground for Ukraine continue to remain complicated as both sides dey struggle for battlefield advantage wey go give dem upper hand for any negotiations to take end di nearly three-year war.

Di Pentagon last week don unveil U.S. intelligence wey predict say Russia fit again com launch dia lethal new intermediate-range ballistic missile against Ukraine soon.

Putin don deploy di missile for di first time last month days afta Biden loosen di restrictions on Ukraine.

Putin warn di West say Russia’s next use fit be against Ukraine’s NATO allies wey allow Kyiv to use dia longer-range missiles to fire inside Russia.

Biden agree to loosen di restrictions afta Zelenskyy and many of him Western supporters don press Biden for months.

See also  US VP Harris tipped to replace Biden Amid Concerns Over Debate Performance

Dem argue say di U.S. ban don make am impossible for Ukraine to try to stop Russian attacks for dia cities and electrical grids.

Di outgoing president don ultimately make di decision last month amid some concerns about Russia to deploy thousands of North Korean troops to take help am claw back land for di Kursk border region wey Ukraine seize dis year.

 

 

 

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

2027: Tinubu’s endorsement by APC govs won’t give him victory — Ndume

Enraged LA protesters flood the streets, say they are not afraid of Trump

JUST IN: China introduces pain-free childbirth to boost population

More Senators desert LP as Edo lawmaker defects to APC

Trump’s travel ban takes effect: 12 countries face entry restrictions

Fix Nigeria first! – Peter Obi slams Tinubu’s coastal highway plan amid national insecurity crisis

Ireland deports 35 Nigerians, including children

BREAKING: Abia Lands Commissioner, Chaka Chukwumerije, Survives Assassination Attempt

We’re under siege, terrorism eating up Benue — gov Alia

Akwa Ibom Youth Development Commissioner rallies Diaspora support for ARISE Agenda

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks