Connect with us

Pidgin Corner

Femi Kayode padi, don slump, die for inside hotel room for Abuja

Published

on

Femi Kayode padi, don slump, die for inside hotel room for Abuja

Di Former Minister of Aviation, Chief Femi Fani Kayode, don announce di sudden death of him aide, Mr. Ndifreke Saviour Mark, wey him talk say die for hotel room on October 21, 2024.

Kayode talk say Mr. Mark die for statement wey him release on Monday.

According to Kayode, late Mr. Mark, wey sudden slum and die na devoted Catholic.

Say afta Church service on Sunday, him go one hotel wey dem just dey call Mildy Lodge and Apartments for Garki, Abuja.

Him talk say Mr. Mark take one room for di hotel and spend some time dire wit one pesin wey him no quote for di statement, afta dat, e apparently slump and die for di pesin presence.

Chief Kayode still come talk say him Mark carry go Asokoro District hospital, wia dem later pronounce am dead wen him reach.

Him come add say him padi wey wey just die say him body don dey deposit for di hospital morgue since den.

Meanwhile, three suspects don dey arrest by di police for di ongoing investigation concerning di mata.

Di statement talk say, “E dey wit great sadness say I announce di passing of my devoted Special Assistant, Mr. Ndifreke Saviour Mark, wey dey wit me for not less dan 34 years.

“He left house for 5:40 AM for di morning of Sunday October 13, him go morning Mass as e be devoted Catholic and member of di Catholic Church of Assumption, Asokoro, afta dat, e go one hotel wey dem dey call Mildy Lodge and Apartments for Garki, Abuja.”

See also  Mohbad's mother and wife don reconcile

“According to di police, e take one room for di hotel and spend some time dire wit one pesin afta which e apparently slump and die for dat pesin presence.”

“Dem carry am go Asokoro District Hospital, dem pronounce am dead wen e reach and e don dey put for di hospital morgue.”

“Di pesin wey dey wit am at di time of him death for di hotel don dey police custody now and I don insist say make dem do full criminal investigation of di mata and autopsy.”

“Di hotel receptionist don also dey detain by di police while bot di manager and di owner of di hotel don invite for questioning earlier dis week.”

“Di whole hotel don also seal up by di police for two days and di room wey e lodge still dey seal till today.”

“I don break di sad news to him family, I don meet wit him wife Barrister Patience Ndifreke-Mark and him Uncle, Mr. Clement Mathias, (wey represent him family) and I don also tell dem say I go make sure say, if truly dire dey any foul play, justice go happen and those wey dey behind am go face di music.”

“Mark na like son to me and him passing na big blow to me and my whole family.”

“We share plenty dreams and aspirations and fight plenty battles togeda shoulder to shoulder.”

“Now wey e don go, e don leave plenty pain but I dey give thanks to God for him life and for di 52 years wey e spend for earth.”

“I don assure him wife and family say I go stand by dem for dis difficult time and make sure say dem no lack or want for anything.”

See also  Penn State Professor im girlfriend and im uncle push am for big building for Million Dollar Plan

“I get absolute confidence for di FCT Police Command to find di bottom of dis mata afta which we fit proceed to bury pesin wey be my most loyal staff and most trusted aide.”

“Most important of all na di fact say e be kind, reliable and compassionate soul wey bring joy to plenty pipo and wey no fit hurt fly.”

“I go never forget am and though e don pass, e dey live on for our hearts.”

“I thank all dose wey don find time to come mourn wit us for dis difficult time.”

“May Ndifreke precious soul rest for peace and may di Lord comfort him wife and two beautiful young children.”


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

Fulani Carnage Can Be Stopped – None Vaillant Campaign

CBEX restores wallet balances of subscribers

UK mum in tears as baby diagnosed with rare genetic condition that has no name

“No judiciary in 2027”: Nigerians reject courts over electoral injustice

Top High-Paying Nigerian Jobs Without University Degree in 2025

Man ends it after 12-year search for $742M lost Bitcoin hard drive

EU adds Monaco and 5 African countries to Blacklist for financial crimes, removes UAE

REVEALED: How Tinubu “killed” Jesutega Onokpasa

Open Letter to Atiku Abubakar on the Essence of Sacrifices

PDP bleeds as 12 lawmakers, govs defect to APC

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks