Connect with us

Pidgin Corner

Israel don attack Gaza even in di  middle of di ceasefire negotiation

Published

on

Israel don attack Gaza even in di middle of ceasefire negotiation

At least 14 pipo don die from Israeli attacks across Gaza dis morning, including 10 wen Israeli fighter jets bomb one residential building for Gaza City, amid reports of ceasefire talks wey don dey com closer to agreement.

Di attack for Gaza City target di Tabatibi family home for di Daraj neighborhood.

Di Footage dey show say fire dey burn afta di attack as rescue workers dey search for survivors amid di rubble.

Local media report talk say di family don run comot for di house, wey dey near for di eastern part of Gaza City.

Al Jazeera’s Tareq Abu Azzoum, don report from Deir el-Balah for central Gaza, talk say di house dey targeted without any prior warning.

“Civil Defence workers confirm say di vast majority of bodies don shred to pieces,” Abu Azzoum talk.

Dis morning, Al Jazeera’s correspondents for di ground also report fighting for Rafah’s al-Janina neighborhood as well as Israeli helicopters dey shoot east of di southern Gaza city.

Meanwhile, di World Health Organization (WHO) don call for ceasefire as dem warn of di “shocking” conditions for one of northern Gaza’s only functioning hospitals.

“Di conditions for di hospital dey simply shocking,” WHO chief Tedros Adhanom Ghebreyesus talk about Kamal Adwan Hospital for Beit Lahiya, one city wey dey witness intense attacks by di Israeli military.

“We dey urge for di protection of health care and for dis hell to stop! Ceasefire!”

WHO and partners reach di facility “two days ago, amid di aggression don dey escalate and explosions for near dat particular place of di hospital during di mission”, Tedros add for post on X, afta efforts to deliver needed supplies don dey repeatedly don make am even difficult to proceed or achieve di goal by di Israeli army.

See also  Sylvester Oromoni mama don die seven month afta court dismiss case

Di mission reach di hospital for November 30 afta weeks of unsuccessful attempts, but days later dem force am to flee amid attacks and aggression around di facility.

Hussam Abu Safia, director of Kamal Adwan Hospital, talk say Israeli snipers also attack di hospital’s intensive care unit.

“Dis development dey very serious and na something new for us,” na so him talk.

“We no fit stay for dis place wey suppose provide ICU services. But at di same time, we no fit evacuate and move to anoda place.”

Him com add say power generators don hit again, causing power outage.

Bombs launched from quadcopters also don dey target di hospital’s premises.

Ceasefire deal close

On Monday, Israel’s Minister of Defence Israel Katz com talk say negotiators neva dey closer to deal since di November 2023 agreement.

Hamas talk say dem no go accept anything less than complete and permanent cessation of di war, full withdrawal from di entire Gaza Strip, di return of di displaced and prisoner exchange deal.

For previous rounds, disagreements ova di new demands wey Israel introduce about dia future military presence for Gaza obstruct deal, even afta Hamas don accept version of di proposal Biden introduce for May.

One round of di talk for mid-October don fail to produce deal.

Late on Monday, Netanyahu’s office talk say di PM hold meeting with Adam Boehler, Donald Trump’s don officially choose envoy, to take reach di deal for di captives’ release.

Seven individuals with US citizenship don remain for Gaza, with four confirmed dead, Israeli officials talk.

See also  JOHANNESBURG: South Africa don close im border again with Mozambique, as post-election wahala don dey worsen

Netanyahu also speak with Trump ova di weekend regarding Israel’s efforts to secure di release of di captives.

On Monday, State Department spokesman Matthew Miller also follow  talk say negotiations don dey productive for recent days but differences remain.

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

The Swat River Tragedy: A Family Lost, Pakistan Shaken

Crypto Fraud Case: Court Denies Bail to CBEX Promoters as $1bn Allegations Deepen

Why Samuel Anyanwu was reinstated as National Secretary of PDP

2Baba Speaks: The Truth Behind African Queen

S’East may leave PDP if crisis persists — Gov Mbah

Peter Obi’s Camp Confirms Plans to Exit Labour Party, Join Unified Opposition Ahead of 2027

Trump Flips the Switch on Syria

China’s Shadow Strike: A Bomb That Doesn’t Explode, But Still Paralyzes

Security forces kill notorious bandit commander in Zamfara

‘Blackmail Tariffs’–Macron Blast Trump as Trade War Heats Up

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News