32.3 C
Lagos
Wednesday, February 18, 2026

Late Mohbad’s wife Wunmi don finally confess

Share this:

Mrs. Omowunmi Aloba Wunmi, di widow of late singer Mohbad, on October 12, 2024 don finally com confess inside di rumour for social media wey dem talk say she don carry belle.

according to Daily News, on October 12, Mrs. Wunmi, di widow of late singer Mr. Mohbad, don finally com confess following di allegation inside di social media wey carry di rumour say she don get belle.

Di alleged pregnancy rumor, wey dem talk for inside social media personality Mr. Baba Latisneh’s TikTok don turn big wahala.

Wetin dey happen for social media no be small.

Late. Mr. Mohbad fans, pipo wey just dey look like say dem bi online detectives dey try to find out wetin really dey happen behind di scene.

READ ALSO:  June 12: How Tinubu can fulfil Abiola’s dreams for Nigeria – Gani Adams

Na so rumors start to spread like wild-fire say Mrs. Wunmi, di widow of late Naija artist Mr. Mohbad don carry belle.

Dis tin shock com all di fans well-well as dem begin dey critics am well-well fro di mata.

Di tori dey under serious scrutiny for TikTok platform.

Di twist com shock pipo well-well, and e com dey spark plenty-plenty talk wey range from “no dey possible”, to “no bi true, to “wetin dey happen?”

My pipo, Mohbad widow, don find herself for di middle of rumors and speculations wey dey send shockwaves across social media.

Since di sudden and tragic dead of di Naija artist, pipo dey ask plenty-plenty questions, accusations dey fly around left and right, and pipo dey monitor Wunmi well-well.

READ ALSO:  Guber, House of Assembly Election: CLO calls on Anambrarians to vote with their conscience & conviction

Now, dis latest bombshell don explode for inside di internet, say di late. Naija artist’s widow don get belle recently.

Dis one don add fuel to di controversy wey already dey for inside Mr. Latisneh TikTok platform, wia him followers wey claim say dem get inside knowledge of di breaking news.

Di tiktoker, wey dey close to di Aloba family and dey always comment on Mohbad saga, nearly faint wen him followers tell am say e bi like say Wunmi don get belle.

Di tiktoker com ask dem for permission to make som urgent phone calls make him for verify di allegation, but instead of dem get clarity for di mata, di tori com scatter.

READ ALSO:  BREAKING: Autopsy failed to reveal cause of Mohbad’s death – Pathologist

My pipo, na so social media pipo com start to dey accuse di widow of deceit and moral failings.

Di allegations no be small, some pipo dey question her loyalty to di late artist, while odas dey insinuate say she fit dey hide more than just grief.

But dis latest development don send di online community pipo dem into frenzy, reactions dey flood in from everywia.

Some pipo no believe say Wunmi fit dey pregnant, especially during dis hard time.

Others no believe di rumor, dem dey doubt say e no be true.

Wetin you think?

You believe say Wunmi dey pregnant?

Share this:
RELATED NEWS

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

- Advertisment -

Latest NEWS

Trending News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks