Connect with us

Pidgin Corner

Papa and him six-year-old pikin dey among di victims wey die for Anambra

Published

on

papa-and-him-six-year-old-pikin-dey-among-di-victims-wey-die-for-anambra

One six-year-old boy and him papa dey among di pipo wey dem kill during di killings wey follow di cult clashes for di Nibo area of Anambra State on Sunday October 20, 2024.

According to report, on Monday gadir say di pikin dey play around di premises of him papa shop wen stray bullet hit am during di attack October 20,

Some hoodlums wey dem neva fit identify yer, on Sunday aftanoon, don storm Oye Nwochichi Market, Nibo and Eke Nibo Market, near di place wey di community New Yam festival wey dem dey call “Olili Onwa Asaa” dey happen and dem open fire on di pipo wey dey enjoy, kill no less than 13 pesin.

Di Security Director of Nibo Community, wey dem just identify as “Wadara”, come talk say one only son of him parents, Uchenna, na among di pipo wey dem gun down for di bloodshed.”

Di Security Director continue talk say, “One six-year-old also get bullet during di attack, so also him papa, wey dem just identify as Echee, na shop owner for di Oye Market for di community, wia di pipo first open fire, kill plenty pipo.

Di deceased, wey neva marry, also na one of our vigilante officers.

Him dey on patrol duty, dey watch over di place, bicos of di grand finale of di ‘Olili Onwa Asaa’ cultural festival of di community wey dem plan for di day, before di hoodlums strike and shoot am down afta dem exchange gunfire.”

While him dey talk say plenty injured pesins don rush go hospital, him also add say di corpses of many of di murdered victims don identify and carry by dia relatives for burial.

See also  Fiscal strength and healthcare: Anambra dey shine among top 5 states unda governor Soludo

Di family members of di deceased no gree talk to news pipo as dem say dem no dey in di right frame of mind to do so.

Meanwhile, for one viral voice note for social media, one of di survivors of di attack talk him near-death experience, add say na only di Grace of God save am.

Him talk say, “Di pesin wey shoot di three pipo don point di gun at me and dey about to pull di trigger before one of him members tell am say I no dey among di pipo wey dem dey hunt.

“As him dey about to pull dat trigger, him come push di pesin down, and di bullets splash for di wall behind me directly.”

Di state police spokesman, SP Tochukwu Ikenga, for one statement wey dem issue on Sunday, talk say di incident na cult-related clashes between rival cult groups.

Meanwhile, di Commissioner of Police for Anambra, CP Nnaghe Obono Itam, on Monday lead some operatives go di scene of di incident for Nibo.

During di on-di-spot assessment, di CP talk say di command don double dia efforts to make sure say dem no leave any stone unturned for hunting di assailants.

Itam insist say di police dey committed to arrest di pipo wey do di wicked act while him dey condemn wetin him call “di act of conspiracy to bury evidence and disrupt di ongoing investigation by some community members.”

Him talk say, “Di Anambra State Police Command dey committed to di ongoing investigation and to arrest di pipo wey do di cult-related killings for Nibo October 20, wey record five pesin dead and three odas seriously injured and dey receive treatment for hospital.

See also  Fire breaks out at Starmer's London home, police launch investigation

“Di command also no like di act of some deceased relatives to bury evidence, suppress information and disrupt di ongoing investigation.”

Him, however, talk say no arrest don happen so far while him dey call for pipo wey get useful information to come forward to help police for dia ongoing investigation.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

JUST IN: Iran Supreme Leader issues last order amid fear of assassination

Inside the bunker: Iran’s Supreme leader prepares for war and succession

CANNIBALISM: Russian soldier kills, eats up comrade for two weeks

Deadly storm leaves trail of death and destruction in North Dakota

JUST IN: NNPC – Soneye caps a bold era of reform

What Google doesn’t want you to know about its new search plan

Two clerics face trial for N280 million fraud allegations

Self-Proclaimed Islamic Clerics Arrested for N280 Million Scam

Explosions, Airstrikes, and diplomacy on hold in Iran-Israel showdown

NIS, BCDA join forces to enhance border security

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks