News
Plenty pipo don die afta petrol tanker cos explosion for Jigawa inside Nigeria

Plenty pipo don die afta petrol tanker explode for Kano-Hadejia expressway inside Taura Local Government Area of Jigawa State on Tuesday October 15, 2024, night.
Plenty pipo don die afta petrol tanker explode for Kano-Hadejia expresswayon October 15, inside Taura Local Government Area of Jigawa State on Tuesday night.
According to Mr Zagazola Makama, expert on top counter-insurgency for Lake Chad region, break di news on Tuesday October 15.
Him talk say di explosion start around 11:45pm and no stop till 3:15am on Wednesday.
“Wicked fire burn plenty pipo to death afta petrol tanker burst for Kano-Hadejia road inside Jigawa State on Tuesday night.
Him talk say di blast cause big fire wey kill plenty pipo and leave at least 300 pipo wounded bad.
Di fire spread quickly, cause plenty damages and overwhelm di emergency pipo wey come for rescue.
“Authority no gree talk say how many pipo die, but dem dey work tirelessly to rescue and recover.
Dem also dey try to know who be di victims and give medical help to those wey get don injured for di sad incident.
“Dem dey try identify di victims, give medical help to those wey survive di tragedy.”
“As dem no know how many pipo die, but dem dey hustle to save lives.
Dem dey find out who be di dead bodi, and give treatment to dose wey still dey breathe.”
Di driver, wey no injure dey police custody while dem dey conduct investigation.
Dis na di third time for 2024 wey price of fuel dey go up.
E don rise from about 187 to 1,100 naira in just one year.
Dem cover some of di dead bodies with tree branches as pipo gada to look.
Dis incident dey happun as citizens of Nigeria dey cry under di latest hike in price of petrol wey many say don dey above di reach of di masses.
Dis na di third time for 2024 wey price of fuel dey go up.
E don rise from about 187 to 1,100 naira in just one year.
Meanwhile, fuel tanker explosions and accidents dey common for Nigeria -e dey happun sometimes sake of bad roads and vehicles.
Earlier for September, 59 people die for Niger state after one fuel tanker jam lorry wey carry passengers and cattle.
Police say dem go do investigation to find wetin cause di tanker accident wey make plenty pipo lose dia life.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook