Connect with us

Pidgin Corner

Sean Diddy name don dey 7 new lawsuit

Published

on

Sean Diddy name don dey 7 new lawsuit

Seven new civil lawsuits don dey file against Sean “ P Diddy” Combs, including two from pipo wey talk say dem be minors wen dem allegedly drug dem and assault dem by di music producer  October 21, 2024.

According report, on  October 21, for di first time for di many years, wave of litigation against Combs, oda celebrities dey mentioned and don dey accused of participating for di alleged assault, but dem no mention dem names.

For one lawsuit wey one Jane Doe come file, she talk say she be 13 years old dat time for year 2000, wen one limo driver invite am to attend MTV Video Music Awards afta-party wey Combs throw for New York City.

Afta she drink one beverage, Doe complaint talk say she begin dey feel drowsy, and she come dey look for place to lie down.

Combs, wit one man wey follow be celebrity wey she no mention him name and one female celebrity wey she still no mention name, come enta di bedroom wia she dey rest.

Di male celebrity come dey come near Doe to rape am, while Combs and di female celebrity dey watch. na wetin  her lawsuit talk.

Leta Combs come rape Doe as di odir two celebrities dey watch, according to her lawsuit.

Wen dem reach Combs for comment, him representatives refer CNN to one previous statement from him lawyers wey dem deny di allegations for six odir lawsuits wey dem file last week.

“Mr. Combs and him legal team get full confidence for di facts, dem legal defenses, and di integrity of di judicial process,” Combs’ lawyers talk for di statement.

“For court, di truth go prevail, na so Combs talk, him say him neva sexually assault anybody adult or minor, man or woman.”

Di newest lawsuits, five of dem wey dem file for federal court for New York and two for New York Superior Court on Monday, include allegations of rape, sexual assault, sexual harassment, battery, or false imprisonment by Combs between 2000 and 2022 for New York, Los Angeles or Las Vegas.

See also  Sean ‘Diddy’ Combs pleads not guilty to superseding indictment

All di alleged incidents happen for parties wey dem talk say Combs host.

Three plaintiffs na women and four na men, dem submit as eidir Jane Doe or John Doe.

All but one dey allege say dem drug dem by Combs.

Anoda accuser come follow talk for him claim say he be 17-year-old wey dey aspire to be artist for 2022, wen dem allegedly drug am for one party and sexually assault am.

Him talk say Combs, bin offer him drink and “assure am say him fit make am star.

Di Monday’s lawsuits come join oda against Combs wey dem file last week by Houston-based attorney Tony Buzbee and co-counsel Andrew Van Arsdale, wey don talk say dem dey represent at least 120 alleged victims of Combs, including minors.

Di Federal prosecutors don come accuse Combs of orchestrating one “criminal entaprise” through him business empire wey dey engage for sex trafficking, forced labor, kidnapping and decades of physical abuse against women, and many odir allegations.

He don plead not guilty to federal charges of sex trafficking, racketeering and transportation wey dey engage prostitution.

Dem don hold Combs for custody for New York as he dey wait for trial, wey go start inside May.

Combs lawyers dey ask di appeals court to put one appeal on hold so him fit bring new information come di attention of di federal judge wey dey oversee di case, Judge Arun Subramanian.

Prosecutors don oppose am say make dem no pause any appeal.

Before Combs seek di delay, di federal appeals court don schedule oral arguments on him detention for November 4.

See also  Dis drop out of School children dem na big threat to Development – Gov Sani

Over di weekend, him attorneys don ask Subramanian to issue one orda to prohibit some potential witnesses and dem lawyers make dem no dey talk about di allegations against Combs.

“Dis Court suppose don exercise him discretion to take issue one orda wey go require all di potential witnesses and dem counsel to refrain from making extrajudicial statements wey get substantial likelihood to interfere wit Combs’s trial or odirwise prejudice di due administration for justice,” Combs’ lawyers write to di judge.

Since November 2023, at least 25 civil lawsuits don dey file against Combs wit allegations of sexual assault or misconduct.

Di initial lawsuit, wey him former girlfriend Cassie Ventura file, don settle di next day.

Di odir cases still dey active. Combs don deny all di allegations.

Prosecutors don talk say di criminal investigation dey ongoing and additional charges or defendants fit dey add for possible superseding indictment.

 

Sean ‘Diddy’ Combs dey face new lawsuits, including claim say he drug and rape 13-year-old girl wit one unnamed ‘male celebrity’ as one unnamed ‘female celebrity’ dey watch.

Anoda round of lawsuits don dey file against Sean “Diddy” Combs, including allegation say he drug and rape one 13-year-old girl wit one unnamed “male celebrity” as one unnamed “female celebrity” dey watch.

Di Buzbee Law Firm, wey talk on Oct 1, say dem go present 120 more lawsuits against Combs, don file five new suits for Southern District of New York on Sunday night.

Two more suits don also file for Las Vegas and Los Angeles, respectively.

One of di suits come from one Jane Doe wey be 13 years old on Sept. 7, 2000, wen she try attend di MTV Video Music Awards.

She no fit enta di awards show witout ticket, so she come approach several limousine drivers afta di event to see if she fit attend afta-party.

See also  Double homicide: Florida set to execute man for 1993 murder

One of di drivers wey allegedly work for Combs come carry di plaintiff go one party, wia she sign non-disclosure agreement and accept drink.

Afta just one drink, di plaintiff allege say she “begin dey feel woozy” and she come go enta one of di empty bedroom to lie down.

Soon afta, Combs allegedly enta di room wit “one male and female celebrity.”

She come allege say di male celebrity rape her as di female celebrity dey watch, before Combs allegedly rape her as both celebrities dey watch.

Di suit come dey allege say afta di assault, di plaintiff wey dey live now for Alabama “fall into deep depression wey still dey affect every aspect of her life.”

One representative for Combs no come respond immediately to Variety request for comment for di new lawsuits.

But Combs don repeatedly deny all allegations against am.

For one of di statement of Variety, him lawyers talk say: “Mr. Combs and him legal team get full confidence for di facts say, di legal defenses, and di integrity of di judicial process.

For court, di truth go prevail: say Mr. Combs neva sexually assault anybody adult or minor, man or woman.”

Combs currently dey prison for Metropolitan Detention Centa for Brooklyn, New York.

Afta dem arrest am on September 16, by di Homeland Security on charges of racketeering, sex trafficking and transportation to engage into prostitution.

Him come plead not guilty to di charges, Combs don dey denied bail by two separate judges, and e go remain for behind bars until him trial for May of next year.

If dem find am guilty of racketeering, Combs fit face life for prison.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

Nigeria enhances global health cooperation at BRICS meeting

Breaking: Nigeria’s first female fighter pilot makes history in Ghana.

Tragedy: Gunmen kill disabled man and artisan in Imo community

Just in: Lagos port officials watch as cargo ship catches fire

Breaking: Navy uncovers and seizes stolen crude oil in Delta

Okey Bakassi Crowned Traditional Ruler in Imo Community

2027: Atiku’s Aide denies ADA adoption by opposition coalition

Just in: NDLEA chairman, Gen. Buba Marwa, loses mother-in-law

Mysterious Disease breaks out in Imo Community, kill six people

NPA prevents major disaster at Lagos port complex

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks