Connect with us

Pidgin Corner

Lion don kill man fo Obasanjo Library Zoo

Published

on

Obasanjo Presidential Library Zoo bring bad News

Obasanjo Presidential Library Zoo, on Sunday, September 29, 2024, bring bad news say lion wey dey there don attack and kill one Mr. Babaji Daule, di lion handler.

According to di tori for Punch News on September 29, dem say na carelessness don mek Lion wey dey former Nigeria President Mr. Olusegun Obasanjo Zoo go kill man wey dey take care of am.

Mr. Babaji na from Bauchi State, na him bi di Lion handler wey dey carry food go giv di Lion wey don die so.

As di tori com bi, dem say di Lion handler wey bi Mr. Babaji no secure very well di gate wey dey kip di Lion.

Na e mek di animal com run comot for di cage wey dem for kip am go attack di man according to di Chief Security Officer (CSO) incident report by 7:40 AM.

Police don visit Mr. Obasanjo zoo and dem don confirm am say dem later carry di victim body go mortuary for Ijaye General Hospital.

As dem talk say dey even shoot lion to tak release di Lion grip on di handler body.

Eyewitness

Di eyewitness wey bi Mrs. Goodness Alabi, com dey yarn say, di mata na very horrifiying situation.

As she dey nearby wen she hear as di Lion dey roar and di man dey screams very loud.

“Di man neck dey for di Lion jaws as e dey bite am, we com dey try to intervene to see how we go take serve am comot but e be too dey late.”

See also  Simon talk say him no dey worried about Naija 2026 World Cup hope

she say di mata com even get worse as lion grip handler neck, com cos big fatal injuries wey lid to him death.

Ogun State Police Command

Ogun State Police Command don confirm am, say dey even shoot lion to release him grip on di handler body and dem don cari di body go mortuary for Ijaye General Hospital.

As dem talk say dem go investigate di incident to know how di mata tak happen.

Dem promise say dem go mek sure say dem tak serious measures wey go help to prevent such incidents for future.

Expert: Dr. Temitope Ogunniyi

Dr. Temitope Ogunniyi, wey bi Zoo Expert com talk say “Lions dem dey naturally dey aggressive.

And dat na wy dem nid caution around dem, as di Zookeeper dem must to dey follow strict safety protocols wen dem dey handle wild animals like dat.”

Na e com yarn say “as e don com like dis so, say dis incident don highlight di importance of adhering to instructions and guidelines and ensuring enclosures secure.”

Dis no bi first time Lion attack him handler for Nigeria o! say dem don record similar incidents since 1977.

Na so animal rights activist, Mrs. Funmi Adeyemo, don talk say, “dis tragedy for don dey prevented.

She com advise all zoos say mek dem prioritize safety and ensure say dia Lion handlers don receive beta training.”


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

Thunderous Whispers: Poet Laureate—Ugorji Explores 2027 Run

Blue marine alliance slams NIWA over 101 waterway deaths in 2025

Peter Obi swears: I’ll serve only four years

UK under gire for role in Kanu’s detention

Gunmen kill real estate official, dump body after chatting wife with his phone

COPDEM set to inaugurate 3,480 Anambra LGA, ward executives in Nnewi mega rally

Nigeria may not survive if APC retains power in 2027 — El-Rufai

Digital Ambush: Inside the APC’s Multibillion Naira Plot to Silence Dissent Before 2027

Yoruba Ronu Tribal Bigotry: Resetting Igbo Consciousness

Femi Kuti breaks down 20 years after mother’s death

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks