Pidgin Corner
VeryDarkMan don fire Bobrisky counter lawsuit
VeryDarkMan, don yarn bak di celebrity Bobrisky afta dem threaten am wit N1 billion lawsuit on Monday, September 30, 2024.
According to Punch news Report, Bobrisky don send leta thru im lawyer, give social media controversial activist VeryDarkMan, wey for inside di leta im alleged say VeryDarkMan release fake audio wey spoil im name.
For inside di leta, dem com talk say dem demand public apology within 24 hours.
But my pipo as di mata com bi, VeryDarkMan sef no gree tak am lie down.
E com cary di mata enta im Instagram page, for wey im for talk say di audio wey im release be WhatsApp conversation from person wey Bobrisky contact.
Na so VeryDarkMan sef com queshun Bobrisky say why (s)him sef com change demeanor na, afta (s)him don talk say (s)him wan “end am all” bifor na.
Na so di mata com mek VeryDarkMan vex wel wel, com say himsef go threaten im own bak.
Say as di mata stil dey hot imsef must to countersue Bobrisky N1,000,000,020, plus N20 for imself.
E com ask “Bobrisky” say, you talk say you no get strength bifor, but now you don get strength tak sue me N1 billion lawsuit?”
Com talk say for dis very mata so, many pipo go lose dia credibility becos of im publicity.
VeryDarkMan com talk say dis very legal battle so go spoil many pipo name.
I go mek dem regret dis,” VeryDarkMan yarn for im post.
My pipo, dis mata too lon, as di tori don ful groud nyafunyafu lik dis as di mata neva end for dere oo.
Na so VeryDarkMan com talk say di mata connect di Rapper Falz and im Papa Mr. Femi Falana.
Mr. Femi Falana, di Senior Advocate of Nigeria (SAN), na Nigerian lawyer and human rights activist wey dey fight for pipo wey dem dey oppress.
im dey always show say im care about pipo wey dey suffer, and im no dey tire to stand up against pipo wey dey oppress orda pipo.
As di SAN for Nigeria, im get reputation for defending human rights and democracy for Africa.
Mr. Falana don represent mani victims of human rights abuse for court, both for Nigeria and international courts.
As human rights champion wey im bi, Falana don achieve mani tings.
E don difen pipo wey dem accuse wrongly, and im don help man pipo wey dem detain illegally to regain dia freedom.
Falana dey advocate for democratic governance and accountability in Nigeria and Africa.
E don show say im interest na to Promote democracy and good governance for wi country.
im dey fight for pipo right to education, healthcare, and other basic nid too.
But as dey com tak menshun im name for di audio note wey VeryDarkMan release so na wia pipo com dey get plenti question.
Pipo dey ask wetin com concern Mr. folarin Falana we pipo know am as Falz, wed aim don dey nack Bobrisky?
VeryDarkMan com talk say mek Falz com explain giv pipo as di mata tak dey so naija pipo go sabi wetin happen.
Na so, VeryDarkMan com dey query Bobrisky about di N3 million wey dem talk say (s)him bin call rapper Falz to collect.
VeryDarkMan com yarn say, im dey very confident, say him go fit stand for imsef anywhere anyday.
Say as Bobrisky com sue am N1 billion, say him too don ready to mek mockery of am with N1,000,000,020 and N20 gain.”
Wetin com cos di dispute between dem two na audio recording wey VeryDarkMan share.
Di voice note com dey sound like Bobrisky voice, claiming say (s)him bribe EFCC officials N15 million to drop charges against am.
Di voice recording follow talk say Bobrisky “godfather” and Mr. Haliru Nababa, wey bi Controller General of Nigerian Correctional Service (CGNCS) arrange private apartment am.
Bobrisky, wey real name bi Idris Okuneye, comot prison August 5 after dem convict am for abusing naira in April.
Bobrisky deny allegations, say audio fake, and EFCC summon bot Bobrisky and VeryDarkMan for questioning.
EFCC chairman, Mr. Ola Olukoyede, order immediate investigation.
But bifor all dis drama, Bobrisky reveal say (s)him dey battle suicidal thoughts.
Now, tings don dey get messy between dem two. My country pipo wetin una tink for di mata?
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook