Pidgin Corner
VeryDarkMan don show face for House of Reps panel
Mr. Martins Otse, aka VeryDarkMan, di popular social media activist, don appear bifo House of Representative panel on Monday September 30,2024.
According to Arise News report, House of Reps panel bin don, on September 30, invite VeryDarkMan mek im com talk as e tak sabi say Bobrisky get special apartment.
VeryDarkMan, appear fo House of Reps panel wit im lawyer, Barr. Deji Adeyanju to ansa questions about bribery allegations wey im mek against di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) and Nigerian Correctional Service (NCoS).
But Bobrisky no show up but na him lawyer, Averosoghene Omuvwie, com represent am.
Federal government don set up independent panel to investigate allegations of corruption.
Dis panel go look into som correctional service Pesinnel wey provide special accommodation for Bobrisky, wey bi famous crossdresser an social media influencer.
Minister of Interior, Mr. Olubunmi Tunji-Ojo, talk say dis panel must mek sure say NCoS dey transparent and accountable.
E go suspend som officers wey dey oversee Maximum and Minimum Custodial Centres in Kirikiri, Lagos, because of Bobrisky allegations.
Dis Independent Investigative Panel go look into di:
- Allegations: Correctional service Pesinnel provide special accommodation for Bobrisky.
- Minister’s Directive: Panel must ensure NCoS transparency and accountability.
- Suspension: Officers overseeing Kirikiri custodial centres suspended.
- Investigative Hearing: VeryDarkMan appears with lawyer, Bobrisky absent but represented by lawyer.
VeryDarkMan, an im lawyer, Barr. Deji don show to ansa di committee.
But Bobrisky no com show for di Committee to ansa for di allegation wey verydarkman put for im head.
Bobrisky lawyer com talk say im client no fit com becso im dey sick.
Di Committee ask di lawyer mek im bring di doctor’s report, but lawyer say him no get am.
Na so VDM no gree talk again, im say: “Me no know wy I dey here wen Pesin wey mek allegations no dey here.”
Say e bi lik say Bobrisky godfather tell am mek im no come.
Say im don disrespect di committee as e no gree show up.
Na so VDM com swear say if Bobrisky no dey, im sef no go talk.
But di Chairman, Hon. Ginger Onwusibe, com tell say VDM im no fit dictate to dem.
Him say, “You no go tell us whether Bobrisky go come or not, na us go decide.
We fit compel am to come, and even arrest am if necessary.
Na your allegations don bring top government officials com here, so you must talk.”
VeryDarkMan stubborn, say im lawyer, Mr. Adeyanju, go talk instead, despite committee’s threat to arrest am.
But Adeyanju advise am to cooperate wit committee.
VeryDarkMan explain say im get audio recording from Pesin wey Bobrisky owe money.
E com submit part of di recording to di committee and accuse Bobrisky of paying millions to secure beta prison conditions.
Bobrisky deny allegations, while EFCC and NCoS investigate.
Him tell committee say, “Me explain everything for video wey I post online.
Pesin lend Bobrisky N4 million wen im dey EFCC detention.
EFCC no go dey harass young boys while Pesin with godfather dey do anyhow.”
My country pipo, una remember say monie lundering charge bin dey Bobrisky case wit di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
But di big question bi say, wetin com happen about di bribery allegations wey (s)him bin get against EFCC and Nigerian Correctional Service (NCoS).
im allege say Bobrisky, di famous crossdresser, pay EFCC N15 million to drop money laundering charges against am.
EFCC don tell Committee of House of Representatives say as dem drop monie laundering charges against Bobrisky dey lawful and follow Administration of Criminal Justice Act (ACJA) guidelines.
Dem explain dis to committee wey dey investigate corruption allegations against some EFCC and Nigeria Correctional Service officers.
You fit wonder why dem drop di charges, but EFCC get reason for dat action.
Dem say dem follow rules and regulations to take dat decision.
Now, mek we wait and see wetin go happen next for di mata.
Mr. Bilikisu Bala, wey bi di head of di prosecution team wey dey handled di mata tel di committee wy dem drop di monie lundering mata.
Mr. Bala tel Committee say dem drop monie lundering charges bicos, Special Control Unit against Money Laundering (SCUML), reveal say Bobrisky firm, Bob Express, no be Designated Non Financial Institution, Business and Profession (DSNFIBP).
Dat means dem no fit prosecute am for breaking di rule according to di SCUML Act, 2022.
Bala explain say, dem initially charge Bobrisky wit six counts, including Naira Abuse and Money Laundering.
Based on im confesshun say im firm no register wit SCUML and no dey giv dem returns.
But afta dem writ SCUML to confirm, dem discova say Bob Express no bi DSNFIBP, so dem drop di money laundering charges and focus on Naira mutilation wey Bobrisky don plead guilty for.
And also pay som millions giv Nigerian Correctional Service (NCoS) tak get special apartment tak stay instead of prison.
But Bobrisky don com deny di allegations, say di audio clip wey VeryDarkMan post online bi fake.
(s)him com yarn say dat voice for di audio clip na Artificial Intelligent (AI) generated audio do am.
Na im VeryDarkMan com yarn say, “di recorded audio clip na from Pesin wey dey Bobrisky contact, wey record conversation giv am.”
VeryDarkMan say im no fabricate ani audio, say na di original recording bi dat.
Nigerian Bar Association (NBA) don urge Attorney General of Federation (AGF) and National Security Adviser (NSA) to do independent investigation for di allegations.
VeryDarkMan initially no wan to talk to committee because Bobrisky no dey present, but lawmakers insist say im must talk.
E eventually comply and explain say audio clip be genuine, and e com from someone wey Bobrisky owe monie.
Now, EFCC and NCoS officials dey onda investigation, an VeryDarkMan don provide part of audio clip to committee mek dem review.
Bobrisky reveal say im dey struggle wit suicidal thoughts, say e wan kpai imsef afta di bribery allegations com surface.
Im accuse Bobrisky say im bribe EFCC N15 million to drop charges, and get special treatment for prison.
But Bobrisky no gree, as e talk say di audio clip na fake.
Now, EFCC and NCoS dey under investigation. Wetin you dey think about dis tori?
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook