Pidgin Corner
Former Naija goalkeeper, Peter Fregene, don die at 77

Mr. Segun Odegbami wey bi Mr. Peter Fregene close friend, confirm di news on Sunday October 12, 2024.
According to Daily Sports News, on October 12, Mr. Odegbami com informed di pipo say Mr. Fregene wey bi di former Naija goalkeeper, die afta him don Dey sick for long time now.
“Jus’ now, Fregene, di former goalkeeper for Naija’s Green Eagles, wey dey on life support for one week, don go meet him maker,” na so Odegbami com write.
“Di former goalkeeper die quietly, wia two of him pikin dem and him wife, Mr Tina Fregene dey around am,” na so Odegbami still talk.
Di former naija goalkeeper represent Naija for di 1968 Olympics for Mexico and him play well-well for di national team during 1960s and 70s.
Pipo know am rfor him sharp reflexes and him strength for goalpost.
Dat na why dem dey call am ‘Apo’.
Odegbami com tank everybody wey support di former player wen him dey sick.
“For all Naija footballers, Olympians, sports pipo, him family, friends, and fans, I say big ‘tank you’ and for dose pipo wey rally round am, pray for am, and support am till di end, I dey tank una well-well,” Odegbami yarn dis one again.
Peter Fregene Biography:
Peter Fregene bin born for (1947-2024), for Lagos Naija
Him dey very popular for him football role as goalkeeper for 1960s and 1970s.
Football Career:
- International Career: Fregene bin represent naija national team, Super Eagles for plenty international games, 1968 African Cup of Nation.
- Club Career: him play fro Naija clubs, even di Staionery Stores and Lagos Rangers.
- Goalkeeping Legacy: Fregene bin get very exceptional goalkeeping skills, wey make pipo dey call am “Di Safe Hands”, “Apo”
Achievements:
- African Cup of Nations: Fregene help Naija finish third place for 1976 African Cup of Nations.
- Nigeria Football Federation (NFF)
- Awards: NFF Merit Award for him contribution to Naija football.
Wetin You Need Know About Peter Fregene:
- Former Green Eagles goalkeeper
- Represent Naija at 1968 Olympics in Mexico
- Play for national team during 1960s and 70s
- Nickname ‘Apo’ due to im agility in goal
- Die at 77 after long illness
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook