Pidgin Corner
Donald Trump don make former Fox News host Kimberly Guilfoyle ambassador to Greece

President-elect Donald Trump don announce di former Fox News host Kimberly Guilfoyle as him choice for ambassador to Greece, as him say na because of one longtime relationship wey dem for take do serious campaign with am and she don dey romantically involved with him eldest son, Donald Trump Jr.
“For many years, Kimberly don be very close friend,” Trump write for social media.
“Her plenty-plenty experience and leadership skill for law, media, and politics along with her sharp sense don come make am super qualified to take represent di United States, and protect dia interests for other anoda country.”
Guilfoyle don work for Fox News for more than one decade, she join pesin take dey host “The Five” show and previously she bin dey serve as prosecutor.
Guilfoyle na di latest pesin wey get close relationship with di Trump family to take receive position for him second administration.
Di president-elect choose Charles Kushner, di father of him son-in-law Jared Kushner, make him be ambassador to France.
Trump also select Massad Boulos, di father-in-law of him daughter Tiffany Trump, for one administration job position.
Jared Kushner and him wife, Trump’s daughter Ivanka Trump, serve for di president-elect’s first administration.
Guilfoyle na legal practitioner wey don appear before di House committee wey dey investigate di attack for di U.S. Capitol for Jan. 6, 2021, by one large group of Trump supporters wey dey find way to take overturn di 2020 election.
She dey White House for di day of di attack, according to di committee chairman, Rep. Bennie Thompson, D-Miss.
She bin once dey married to Gavin Newsom, di Democratic governor of California. Dem divorce for 2006. Guilfoyle recently don dey engaged to Trump Jr.
Kimberly Guilfoyle na American television news personality, lawyer, and former prosecutor.
She don serve as advisor and lead di fundraising division of Donald Trump’s 2020 presidential campaign.
Guilfoyle study for University of California, Davis, and di University of San Francisco School of Law, where she earn her J.D. degree.
She become prosecuting attorney for San Francisco and Los Angeles, California, and she be assistant district attorney for San Francisco from 2000 to 2004.
From 2001 to 2006, she dey married to Democratic politician Gavin Newsom, and she be first lady of San Francisco during Newsom’s first two years as mayor of di city.
She later work for Fox News from 2006 to 2018, and co-host di show “The Five” on di network.
She join America First Policies, one pro-Trump super PAC, to campaign for Republicans for di 2018 midterm elections.
Recently, President-elect Donald Trump don nominate her as di U.S. Ambassador to Greece.
Guilfoyle don dey engaged to Donald Trump Jr. since 2020, but recent reports dey suggest say their relationship don end.
She get one son from her second marriage to businessman Eric Villency.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook