Pidgin Corner
ASR Africa don start di re-construction of Mallam Abdulkarim Mosque for Zaria.

Dis historic event na di Zazzau Emirate Council organize, under di leadership of di Emir of Zazzau, His Highness Mal. Ahmed Nuhu Bamalli CFR, LLD.
Di groundbreaking ceremony mark di beginning of one remarkable journey and get top-top pipo for attendance including di Chairman of ASR Africa and BUA Group, Alhaji Abdul Samad Rabiu, royal fathers, Government officials, di Zazzau emirate council, and public members.
Di Governor of di State, His Excellency, Senator Uba Sani wey be di host of di event com acknowledge di presence of di royal fathers wey dey present, especially His Excellency, Alhaji Muhammad Abubakar Sa’ad Abubakar III, di Sultan of Sokoto, as well as oda special guests of honor including di Abbas Tajudeen GCON, Speaker of di House of Representative, Mallam Balarabe Abass Lawal, Honorable Minister for Environment and Alhaji Abdul Samad Rabiu CFR, CON, Chairman ASR Africa, and di BUA Group.
Di Governor com express him appreciation to everyone wey don contribute to di reconstruction of di mosque and pray for di blessings of di Almighty Allah on dem.
Him come add say di big beautiful building go serve not just as place of worship but e go attract tourists to di State.
Di Emir of di Zazzau Emirate Council, His Highness Mal. Ahmed Nuhu Bamalli com acknowledge di effort of all di committee members wey don work well-well for di reconstruction of di big beautiful building.
Him don specially thank di Chairman of ASR Africa as him take up di big financial responsibility of di reconstruction of di mosque.
Dis architectural wonderful building bin initially dey build for 1836 and na di testament to di rich history and architectural heritage of di region.
Upon di collapse for August 10th, 2023, di Chairman of ASR Africa, Alhaji Abdul Samad Rabiu take up di reconstruction of di mosque to take give new significance to di region.
Di mosque go fit accommodate a total of 2,000 worshippers for two floors, with large courtyard space accommodating extra 5,000 worshippers.
Oda facilities go include ablution area, library, and ICT center office spaces to provide administrative support to di mosque.
Oda guests wey dey present for di event praise di Chairman of ASR Africa for him generosity and pray for many pipo say make dem follow learn for him kind gesture towards humanity.
About ASR Africa
Di brainchild of African Industrialist, Philanthropist and Chairman of BUA Group, Abdul Samad Rabiu, di Abdul Samad Rabiu Africa Initiative (ASR Africa) dey established for 2021 to provide sustainable, impact-based, homegrown solutions to developmental issues wey dey affect Health, Education and Social Development within Africa.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook