Pidgin Corner
Di Mexican Mayor don die six days afta him enta office

Di Mayor of di Capital of Mexico’s violence plagued State of Guerrero don die less than one week afta him take enta office, di state’s governor don confirm am on Octobir 7, 2024.
According to di tori for Arise News on Octobir 7, di mayor of one southern Mexican city don die, dem fit say dem cut him head, few days afta him take enta office.
Mr. Alejandro Arcos Catalán wey dem elect as mayor of Chilpancingo for inside June, don take office only six days bifor him untimely death.
Report dey show say photos wey dey circulate for social media dey show one head wey dem cut put for on top Mr. Arcos’ motor, but dem no fit confirm say na true dem cut him head.
Di mayor death na just one for inside di plenti of violent attacks wey dey against politicians for di area.
Di new city government secretary, Mr. Francisco Tapia, don also die recently.
Senator Mr. Alejandro Moreno don com write for social media say, “dey don kill our mayor of Chilpancingo, Mr. Alejandro Arcos, and just three days ago, dem bin kill secretary of dat same City Council, Mr. Francisco Tapia, dey no even reach one week wey dem dey office.”
Dem bi young and honest officials wey wan make life beta for inside dia community.
Our sad condolences and support dey go to dia families.
Guerrero na one of di states wey dey dangerous for public officials
Guerrero na one state for Mexico Pacific coast.
Di resort city wey dem dey call Acapulco, e dey for one big bay wey big-big buildings and Sierra Madre del Sur mountains dey back.
E dey popular for di high-energy nightlife and di beaches wey dey Acapulco Bay and Acapulco Diamante area.
Performers dey live every day from di iconic La Quebrada cliff enter one small cove.
Di hilltop Fuerte de San Diego, na one fort wey get history museum, e dey overlook di old town.
Di city dey for southwest of Mexico, and dem get around 280,000 pipo dey there.
Dis one no bi di first time wey violence go dey for dat city o.
Dem don even hijack government armored car bifor, and dem don take police hostage. Na real wahala!
Guerrero State na danger zone for government pipo, na death trap for public officials.
Guerrero state dey hot well well for government officials, as dem dey risk dia lives dere.
Chilpancingo bi city for one of Mexico poorest states, Guerrero.
Dem know dat region for corruption, killings and plenti bad bad tingd, especially wit cartel, and dem dey call di area Mexico’s heroin headquarters.
Sadly, many times politicians for dat area dem bi victims of di frequent violence.
Guerrero state na one of di deadliest places for politicians wey wan run for office and journalists.
Dat place dey very notorious for corruption, especially wit cartel tins wey dey happen for dere for inside Mexico.
Dey even dey call am di heart of heroin for Mexico.
Politicians and journalists for dat area dey risk dia lives every time.
Una know say, election no suppose bi mata of life and death, but for dat Mexico, di violence too much for dere.
Ova 330 incidents of violence don happen to politicians during election campaign, from March 1 to June 2
Dis mata na real palava oo! Na sad tins, but we dey hope say one day, election go dey peaceful for Mexico.
Di Governor Mrs. Evelyn Salgado of Guerrero com talk on social media say “di death of Mayor Arcos go make all Guerrero pipo sad and fill dem with anger.”
“You see, two days bifor dem kill di Mayor, him don dey ask for more security protection but dem no gree provide for am”
Dat guy bi newly elected mayor of Chilpancingo, and him death shock everybody for Mexico.
Senator Mr. Alejandro Moreno talk say “dem lose another leader wey wan fight against violence and corruption.”
“Di state of Guerrero for inside mexico, wey Chilpancingo dey, na one of di most dangerous places for public officials and journalists for Mexico.”
“Dem don kill at least six candidates wey run for office for Guerrero bifor di June elections.”
“Dis shocking tin dey follow di killin’ of anoda city official, mr. Tapia, wey bi di new city government secretary.”
“Dem assassinate am three days bifor dem kill Mayor Alejandro Arcos.”
Na double tragedy for di city, and pipo dey sad, dey angry, and dey fear.
Di big question wey dey everybody’s mouth.
Who go bi next?
Na sad tin, bicos di pipo wey dem kill bi di ones wey wan make life beta for di community of mexico.
Di violence for Guerrero state dey too much, and dey need to do something about am fast.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook