Connect with us

Pidgin Corner

Peter Obi faith and him common sense — by Fada Oluoma

Published

on

Peter Obi, Faith and him Common Sense — By Fada Oluoma

Peter Obi don dey trend for Naija public space. Wetin dey interesting for dis current one be say e don provoke some pipo wey dey among him biggest support base; Christians.

E talk something about Night vigils and churches, and how time wey pesin suppose dey used for beta things. Many Christians don vex put for di mata.

Typical Naija Christian or Muslim na perfect example of wetin Aisha Yesusfu don tweet: “dem dey fight God battle and leave dia own battle make God fight am”. Nothing fit be true pass dat one.

Our sharp bishop Hassan Kukah talk say Naija fit die for religious mata but no go lift finger against social, political and economic injustice.

“I no sabi how FAITH dey work for Islam or how dem dey explain am, so I go focus on Christianity wey I sabi.”

“Naija Christians dey live for di illusion say FAITH go solve all di wahala, dem dey ignore, SENSE” (intelligence, gumption, cognition and all di components).

“E be like say wetin plenty of dem get no be FAITH but EXPECTATION, and both of dem dey different.”

Faith no be expectation, e pass that one.

“Dem dey do night vigils, marathon fasts and prayers, dey do plenty religious activities bicos dem get di expectation say things go beta from dose things.”

Things wey COMMON SENSE suppose dey apply, dem dey apply FAITH or EXPECTATION.

“You no fit use FAITH build earthly kingdoms. Every kingdom for dis world na common sense (or e natural equivalent) build am.”

“Na di heavenly kingdom wey you build by Faith. Jesus talk say “my kingdom no be from dis world, if e be, I for don ask for battalion of angels.”

See also  US Catholic don declare bankrupt inside alleged sexual abuse lawsuits

“Naija na funny set of pipo. God give dem mango tree for food, dem cut am down, use di wood build big and fine temples wey dem dey gada go pray to God for food and prosperity.”

“Make you tell me wetin fit pass dat one. Your government dey waste millions of Naira make poor pipo fit go Mecca and Jerusalem every year for pilgrimage.”

“And wen dem come back, dem go still dey poor, e no dey make you vex, but you dey vex bicos Peter Obi talk wetin dey obvious to pipo wey get common sense.”

“Naija no get both faith and common sense, e be tragedy, maybe na tragicomedy.”

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

Israel threatens showdown amid US hesitation

Nigeria enhances global health cooperation at BRICS meeting

Breaking: Nigeria’s first female fighter pilot makes history in Ghana.

Tragedy: Gunmen kill disabled man and artisan in Imo community

Just in: Lagos port officials watch as cargo ship catches fire

Breaking: Navy uncovers and seizes stolen crude oil in Delta

Okey Bakassi Crowned Traditional Ruler in Imo Community

2027: Atiku’s Aide denies ADA adoption by opposition coalition

Just in: NDLEA chairman, Gen. Buba Marwa, loses mother-in-law

Mysterious Disease breaks out in Imo Community, kill six people

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks