Pidgin Corner
US: nobody dey care about Prince Harry or him no popular wife Meghan Markle-Eric Trump

Di ex-president second pikin, don tell Daily Mail say him papa Donald love di Queen and e dey regret how Prince Harry don do big harm to di royal family afta him turn him back on di UK.
According to report, Eric talk say Harry no suppose worry about deportation if Donald Trump win election again for November 5, even though di Duke of Sussex dey face allegation say e fit don lie about him drug use wen him apply for him US visa.
“Truthfully, I no dey care about Prince Harry and I no think dis country dey care too” Eric talk about di Duke, 40, wey dey live for Montecito, California now.
“My papa love di Queen and I think di monarchy na very beautiful thing.”
“Di late Queen dey amazing.”
“Di way wey she welcome my papa with open arms na, like, beyond” Eric talk.
Eric talk say Harry don let him family down wen e quit di monarchy and move go California with him wife Meghan and pikin Archie for 2020.
You go see dis one black sheep wey no sabi wia e dey, led by him wife wey no too popular, both for here and for wia you dey, Eric talk.
E add say “Harry look like say e don go off di deep end and e dey sad to watch.”
But, pipo fit differentiate between di two sides, Eric talk and e describe di royal family as big symbol of Britain.
As e return to di Duke visa status, Eric talk: “I no care if e do drugs. E no mean anything.”
“I fit tell you say our papa and our whole family get plenty respect for di monarchy.”
E come as Harry dey face new wahala over im secret US visa application with one American think-tank dey demand make dem show am afta e admit say e don take drugs for im memoir, Spare.
Di Heritage Foundation dey ask why di Duke fit enta di US afta im talk say e don take cocaine, marijuana, and psychedelic mushrooms for di book wey dem publish last year.
Di conservative Washington DC group don carry lawsuit go against di Department for Homeland Security (DHS) afta dem reject Freedom of Information request.
Di case don come bicos visa applicants suppose by law declare whether dem don take drugs.
If dem no do am, e fit lead to deportation, and Heritage wan make di US Government release di records to see wetin Harry talk about drug usage.
Eric Trump
Eric Trump na di Trump Organization executive vice president of development and acquisitions.
E work with im sister, Ivanka, to redesign and renovate Trump National Doral and im Blue Monster course for Miami, Florida.
For 2013, Trump receive Wine Enthusiast magazine Rising Star of di Year Award.
As di Trump Ukraine scandal dey happen, wey President Trump ask di Ukrainian president make e investigate Joe Biden and im son, Hunter.
Eric Trump sharply criticize Hunter, dey accuse am of nepotism.
Eric talk say, unlike Hunter, Wen my papa become president, our family stop to dey do international business deals.
But wen Donald Trump become president, instead to put im assets for blind trust, e make Eric top executive for di family business, wey still dey operate and promote business transactions for di whole world.
PolitiFact and di Washington Post fact-checker rate Eric Trump claim say di Trump family don come out from all international business as false.
PolitiFact talk say no be only Trump family dey do international business since Trump become president, but some of di president pikin dem, including Eric, don dey celebrate dia international business activities openly during dat time.
For 2017, dem report say Eric talk say “we no dey rely on American banks.”
“We get all di funding we need from Russia, and say we get some guys wey really, really love golf, and dem dey really invest for our programmes. We just dey go dere all di time.”
For 2008, Trump talk say for di mata of high-end product wey dey enta di US, Russians dey make up plenty of our assets, and say we dey see plenty money dey pour in from Russia.
For October 2019, Eric complain about di Bidens, “Why e be say every family go enta politics and dey enrich demself?”
Just before e make dat statement, President Trump don decide say di G-7 summit go happen for di Trump Doral resort, wey Trump Organization get.
President Trump change im mind afta plenty pipo from both sides condemn am.
One ruling wey dem give on February 16, 2024 stop Trump from serving as officer or director for any New York corporation or any legal entity for New York, including di Trump Organization, for two years.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook