Pidgin Corner
Wetin fit happen if government shutdown

As Republicans dey hustle for Capitol Hill to take get new government funding agreement, many federal workers don dey wait to see how government shutdown go affect dem, especially as holiday don dey nearby.
Based on di past government estimates, about 3.5 million federal workers fit no get dia paychecks for dis holiday season until dem reach agreement.
Many of dem, like airport security officers, go still need to show up for work.
Dem Odas fit tell to stay back home and no work.
Payroll schedule for U.S. General Services Administration show say some federal workers fit miss paychecks as soon as January 3, if dem no reach agreement by din.
Federal contractors no dey required to work and dem no dey guaranteed backpay for di duration of di shutdown.
Since fiscal year 1977, dem don get 20 funding gaps, wey last from as short as 1 day to 34 full days.
If government shutdown on Saturday at 12:01 AM, e go be di 21st shutdown.
Impact of di military About 1.3 million active-duty service members go still need work, but without pay until dem reach funding agreement.
Typically, half of di 700,000 Defense Department civilian workforce go still need work without pay.
Generally, contractors no dey required to work and dem go lose paychecks for di duration of di shutdown.
Impact on travel Shutdown go com just as many Americans dey travel for di holidays during some of di busiest travel days of di year.
Di Transportation Security Administration (TSA) talk say about 59,000 of di agency’s more than 62,000 employees dey considered essential and go continue work without pay if shutdown happen.
TSA talk say dem expect to screen 40 million passengers’ ova di holidays through January 2.
TSA Administrator David Pekoske talk say, “While our personnel dey prepared to handle high volumes of travelers and ensure safe travel, make una know say extended shutdown fit mean longer wait times for airports.”
Nearly 13,000 air traffic controllers go need to work without pay, and hiring and training new air traffic controllers go stop during shutdown, according to latest planning document from Department of Transportation.
E worth noting say air traffic controllers play part for ending government shutdown for 2019, wen several workers dey call say dem dey sick for di same day, wey cause air traffic wahala.
President Donald Trump announce agreement to temporarily reopen government dat same day.
Impact on di border About 60,971 employees with U.S. Customs and Border Protection and 17,575 employees with Immigration and Customs Enforcement go need work without pay during shutdown according to latest planning document from Department of Homeland Security.
Shutdown impact Social Security? Bicos dem dey considered “mandatory” spending, payments from Social Security and Medicare go still reach mailboxes, although agencies warn say services fit slow down.
Holiday mail fit dey impacted? U.S. Postal Service no go dey impacted bicos e be independent agency, and e rely on its own revenue stream.
Oda impacts Americans fit see Since shutdown go start on Saturday, many Americans no go really feel di impacts of shutdown until Monday.
National Park Service talk say dem “remain hopeful say lapse in government funding no go occur,” but if e happen, “routine visitor services go dey available through Sunday.”
Dem still dey review agency’s contingency plan and dey work to determine specifics for individual parks.
Smithsonian Institution, wey operate 21 museums and National Zoo for Washington, D.C., plan announcement Friday with more guidance on di impact of shutdown, spokesperson tell ABC News.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook