Connect with us

Pidgin Corner

Republicans don scrap di spending bill afta Elon Musk pressure

Published

on

Republicans don scrap di spending bill afta Elon Musk pressure

Congressional Republicans don scrap one last-minute spending bill wey go keep di government funded till mid-March afta pressure from Elon Musk CNN and The Washington Post report say di bill don die.

Earlier for Wednesday, Musk write for him post for him X account, “Your elected representatives don hear you and now di terrible bill don die. Di voice of di pipo don win!”

Di bi-partisan bill get backing from House Speaker Mike Johnson, wey talk say e dey speak with Musk and Vivek Ramaswamy about dia criticism of di bill on Tuesday.

Musk and Ramaswamy go lead di Department of Government Efficiency, wey go be advisory group to Trump administration focused on cutting government spending.

For him post on X, Musk support idea to shut down di government until January 20, wen President-elect Donald Trump go dey.

Shortly afta Musk’s post, Trump and Vice-elect JD Vance drop statement calling on Republicans make dem renegotiate di bill.

Trump threaten say Republican lawmakers wey no follow line go face political consequences.

“If Republicans try pass clean Continuing Resolution without all dem Democrat ‘bells and whistles’ wey go destroy our Kontri, wetin e go do afta January 20, na to bring all dis Debt Limit wahala com enta Trump Administration instead of allowing am happen in Biden Administration,” Trump write for Truth Social.

“Any Republican wey fit be so stupid to do dis should, and will be Primaried,” Trump add. ” suppose done fully negotiate before I take Office for January 20, 2025.”

House Majority Leader Steve Scalise tell CNN say Republicans scrap di bill afta Trump com out against am.

See also  Technology don give citizens power to demand for accountability – Osinbajo

Di Biden administration later accuse Trump and Vance say dem dey “play politics,” and dem dey hurt di hardworking Americans,” plus creating “instability” with dia last-minute rejection of the legislation.

“say triggering damaging government shutdown go hurt families’ wen dey gada to take meet dia love ones and e dey endanger basic services wen Americans from veterans to Social Security recipients dey depend on,” Press Secretary Karine Jean-Pierre talk inside di statement. “Na deal. Republicans suppose keep dia word.”

Democratic senators blame Musk bicos dey package fall apart, suggest say dis billionaire get serious influence over Congress ability to pass legislation.

Senator Bob Casay, a Pennsylvania Democrat wey lose him re-election bid, tell CNN say Wednesday series of events na “bizarre, disturbing, and dangerous.”

“Just bicos dem dey talk about dis mata bicos one pesin comment trigger dis kind result no b good sign for new Congress or new administration,” he tell the outlet.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

Cyber Threat: What Iran-Linked Hackers Are Planning Against the U.S.

What Harvard Did Not See Coming

A Place for Connection, Struck Without Warning

One Dead, Two Missing as Migrant Boat Sinks Near Italy

P-Square Fallout 2.0: Peter vs Jude Gets Messy Again

NEC Chaos: ‘One Man Cannot Hold Nigeria to Ransom,’ Say PDP Staff

From Pyjamas To Prison: One Man’s Fight For Youth Jobs In Lesotho

Just in: Court Grants Kogi Senator Natasha Bail on Defamation Charges

JUST-IN: Angry Youths Burn NDLEA Office in Kwara

Afreximbank to recruit 250,000 workers in Nigeria

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News