Pidgin Corner
Alberta Premier responds to Trump’s Canada oil claim

Alberta’s premier respond to di President-elect Donald Trump wey dey troll Canada for Wednesday talk say di trade deficit with di kontri na bicos billions of raw materials dey go south wey dey create trillions of wealth for America.
Trump talk say United States “dey subsidize” Canada and e don dey threaten 25% tariff for all Canadian goods.
“No one fit answer why we dey subsidize Canada to di tune of over $100,000,000 every year?” E no make sense!
” Trump post for Truth Social for Wednesday. “Plenty Canadians want make Canada bicom di 51st State.
Dem go save plenty for taxes and military protection. I think say na great idea. 51st State!!!”
Di premier of oil-rich Alberta, Danielle Smith, ignore Trump’s latest “51st state” trolling and try to answer him question.
“Fair question about di trade deficit with Canada Mr. President @realDonaldTrump di reason be say Canada, especially Alberta send billions of raw materials oil, gas, minerals, grain, livestock, timber etc,”
“We dey send all dis go your U.S. refineries and factories wey your big American companies and workers don upgrade coms ell around di world including back to Canada, we be your biggest customer by far,” Smith post for X.
Alberta dey send 4.3 million barrels of oil and gas go U.S every day.
Smith talk say millions of American jobs and companies dey rely “on all dis affordable raw materials from Canada to take make trillions of dollars’ worth for your kontri.”
About 60% of U.S crude oil imports and 85% of U.S electricity imports na from Canada.
Canada ambassador to Washington, Kirsten Hillman don talk say last year U.S get $75 billion trade deficit with Canada.
But she com note say one-third wetin Canada dey sell enta U.S na energy exports and she talk say na dem go be di deficit wen oil prices high.
“We be one-tenth of di size of United States so balanced trade deal go mean per capita say we dey buy 10 times more from di U.S than dem dey buy from us.”
“well If dat na him metric we go surely engage for dat,” Hillman tell Di AP recently.
Smith don talk say she go attend Trump’s inauguration.
Her comments com one day afta Ontario Premier Doug Ford don talk say Trump plan to impose sweeping 25% tariffs for all di Canadian products go be a “disaster” wey fit hurt U.S stock markets.
Canada also na di largest foreign supplier of steel, aluminum and uranium to di U.S., plus get 34 critical minerals and metals wey Pentagon wan collect well-well.
Nearly $3.6 billion Canadian dollars $2.7 billion worth goods and services cross border every day. Canada na top export destination for 36 states in di U.S.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook