Connect with us

Pidgin Corner

Joshua and Dubois go fight again fo Saudi Arabia

Published

on

Antony Joshua dey prepare for rematch wit Daniel Dubois after Saudi Arabia boxing oga wey hin name na Turki Alalshikh, order another kasala between dem two British rivals.

Joshua’s career dey hang like towel wey dey dry for rope after Dubois knock am out for five rounds in front of 98,000 fans at Wembley Stadium, the crowd wey be British record.

Dem dey plan rematch because Joshua get one fight wey remain for him contract with Saudi Arabia boxing boss, Turki Alalshikh and Riyadh Season.

Joshua, him promoter Eddie Hearn, and Alalshikh don dey discuss wetin go happen next after dat brutal knockout.

Hearn talk say all parties dey on board for rematch. “Rematch clause dey come in different forms. We get fight with Riyadh Season. One of our options na to fight Daniel Dubois again, and our contract dey with dem.”

Dubois, wey be 27 years old, dey consider wait for Oleksandr Usyk to rematch am after him lose for ninth round last year.

Him promoter, Frank Warren, talk say him no mind rematch, wey go happen for February.

Joshua and Dubois first kwanta with come see Joshua suffer serious woto-woto for Dubois hand o.

Dem knack Joshua sotey the guy no fit stand up again, and so Dubois take retain him IBF heavyweight championship for Wembley Stadium.

Dat loss sef don make Joshua fall down for world rankings.

Tyson Fury, wey be 36, initially plan to fight Joshua for two-fight wey dem for pay dem reach £150 million.

See also  Romanian club signs up Nigerian soccer talent

But after Dubois win, Fury come choose  rematch with Oleksandr Usyk for December 21.

Despite say Joshua lose, Hearn still dey optimistic about Joshua’s future. “AJ go always want rematch. Daniel want am too; na biggest fight for am, and dem go fancy am.” Hearn also hint say Joshua fit still face Fury next year, no matter wetin happen against Usyk.

Warren agree wit Hearn, say “I no mind dat rematch at all. Dat door no dey locked for me; I go take am off hinges and we go do am.”

Dat rematch go dey exciting sha.

Joshua dey seek redemption, while Dubois wan proof hinself as strong man for heavyweight division.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

Just in: Nigerian Navy destroys illegal oil refinery in Delta

Nigerian sprinter Ofili switches allegiance to Turkey

Just in: Fuel price jumps overnight as NNPC, others increase pump prices

Retired police officer laments ₦2m pension after 35 years in service

Atiku, OBJ, others celebrate Muazu’s 70th birthday

Gulf States on high alert as U.S bombs Iranian nuclear sites

We’ll arm Iran—Russia sends chilling nuclear threat to U.S

CLO rejects imposition of non-indigenes on Enugu security outfit, demands power for town unions

Just In: Imo rep sparks backlash for securing federal jobs for constituents

Impeach Trump now—Congress in chaos over Iran strike

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks