Connect with us

Pidgin Corner

Plenty pipo don die for Israel Gaza’s Nuseirat refugee camp attack- Palestinians

Published

on

Plenty pipo don die for Israel Gaza’s Nuseirat refugee camp attack- Palestinians

More than 30 pipo, many members of di same family, don die for di Israeli attack on one Palestinian house wey civilian pipo dem dey stay.

Palestinian authorities don talk say at least 33 pipo don die for di Israeli attack for di Nuseirat refugee camp for central Gaza, as Israel dey continue to carry serious attacks for all di strip.

Di Government Media Office for Gaza call di Thursday attack one “barbaric and heinous massacre”, talk say most of di pipo wey die na from di al-Sheikh Ali family.

“Di Israeli occupation army sabi say dis na area wia civilian dem dey stay with many buildings wey get plenty house of civilians, children, women and displaced pipo,” di office talk.

Medics tell di news pipo say Israeli fire di attack for one postal office for Nuseirat wey dey for wia all di displaced Palestinian families dey stay, and house for all di area.

Photographs from di scene dey show young children wey dust and blood don cova for di rubble of one collapsed building.

Report say about 50 pipo wound for di deadly attack, com add to di 30 or more wey don die.

For Gaza, e no dey uncommon for aerial attacks to kill plenty members of di same family, as Israel war dey continue enta di second year.

For October 2024, di one-year anniversary of di war, Israeli attack don completely clear out at least 902 entire families for di Strip, according to di Government Media Office for Gaza.

See also  SEDC Board: Di South East lawmakers don go visit Kalu

Throughout di war, facilities and buildings wey dey house di displaced families don dey attacked by Israeli forces dem, wey dey sometime claim, with little evidence, say dem dey used as operation center for di Palestinian armed group Hamas.

Israeli authorities neva talk anything for di Thursday attack for Nuseirat.

Health facilities, journalists, and humanitarian workers don also report say dem dey seriously targeted by di Israeli forces since di fight start for October 2023.

Wen Hamas bin com launch one deadly attack for southern Israel wey kill about 1,100 pipo, most of dem civilians.

Since then, Israeli attacks don kill more than 44,800 Palestinians for Gaza, more than half of dem na women and children.

for Thursday, di watchdog group Air-wars, wey dey assess civilian harm from air attack, don release one report wey talk say Israel campaign for Gaza na “by far di most serious, destructive, and fatal conflict for civilians” wey dem don eva record.

Dem find out for di report say, during di first month of di war, di number of civilians wey Israeli attack don kill for Gaza dey nearly four times greater than di death toll of “any conflict Air-wars don document since dem establish am for 2014”.

Experts and some human rights groups also don talk say di Gaza death toll go likely be wetin dem no go fit count finish.

With thousands more buried beneath mountains of rubble and di strip’s health services dey struggle to maintain operations.

Thursday attack for Nuseirat strike one largely residential area for one of Gaza’s eight historic refugee camps, wey dem establish for 1948 afta di forced expulsion of Palestinians from nearby areas, sometimes called di Nakba or “catastrophe”.

See also  World leaders condemn Netanyahu’s comments on Macron, Carney and Starmer

Na one of di many attack for Gaza throughout di day.

For anoda refugee camp, Jabalia, Israeli forces fire upon Saeed Jouda, one top doctor wey dey work for di Kamal Adwan Hospital, as e dey make him way to treat patients. him die because of dat result.

So an estimated 1,057 healthcare workers don die since di start of di war.

Di Government Media Office for Gaza don also highlight di strains for di enclave’s medical system for Thursday remarks.

“Dis latest crime coincide with di Israeli occupation plan to topple di health system for di Gaza Strip, dey exert massive pressure on medical teams,” di media office talk.

“E dey coupled with continued attacks on hospitals and medical centers, dey put dem out of service.”

“Moreover, di occupation dey prevent di entry of medicines and medical supplies and equipment as part of di crime of genocide.”

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

Gaza food point bloodshed: Israeli fire kills at least four

Badenoch reaffirms call for tougher UK immigration controls

New Nigerian peoples’ party condemns attack on Agwa Residents

Highlife legend Mike Ejeagha buried within 24 hours in his hometown

IHEKWEME EMPOWERS 20 WOMEN WITH ₦50,000 EACH

Osimhen rejects Al-Hilal’s final offer for Europe move

Neymar tests positive for COVID-19 again

Commissioner urges LGA chairmen to develop rural communities

South-East Igbo group distances itself from June 12 democracy day protest

Entire Akwa Ibom Has Moved To APC, Says Nsima Ekere

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks