Connect with us

Pidgin Corner

Presidency: Tinubu don ready to restructure him cabinet members

Published

on

Presidency: Tinubu wan restructure him Cabinet Members

The Presidency for Nigeria don confirm on Wednesday, September 25, 2024, for Abuja State House, say President Bola Ahmed Tinubu go soon restructure him 47 cabinet members.

The Presidency talk say President Tinubu don tell him ministers say mek dem show pipo di achievements of him administration.

E say, however, di government no go chuk mouth put for di petrol price war wey dey happen between di Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) and Dangote Refinery.

As Bayo Onanuga talk am

Mr. Bayo Onanuga, wey be Special Adviser to di President Tinubu on Information and Strategy, com talk dis one for press briefing for State House, for Abuja.

As him dey with Senior Special Assistant to di President Tinubu on Digital and New Media, Mr. O’tega Ogra, an Mr. Onanuga, dem talk say no specific timeline don dey ground for di restructuring.

Dis restructuring wey wi dey hear so fit happen before or after Independence Day on October 1, and e go com be based on wetin pipo dey talk and di evidence wey dem get.

Mr. Onanuga com tell di pipo say, “as di President don talk say him wan restructure him cabinet, say him must to do am.

But wetin him no sabi bi say weda him go do am before October 1, but mek pipo put am for mind say him go shuli do am.

He say Tinubu never give dem any timeline, but di pipo just believe say him go do am as him talk am.”

O’tega Ogra’s join talk

Mr. O’tega Ogra com stil explain say dis 47 cabinet members restructuring go bi base on performance an pesin wey go coordinate dis restructuring na Mrs. Hajia. Hadiza Bala Usman, wey bi di Special Adviser to di President  on Policy Coordination and head of di Central Delivery Coordination Unit.

See also  Trump talk say him wan make di war end

Mr. Ogra com follow talk say di Tinubu ’s disishun to restructure him cabinet members go bi based on evidence and periodic reviews and performance reports.

Him com still talk during di retreat for di ministers, periodic reviews go dey well conducted, and di disishun go guide di restructuring.

Plenty reports don dey concerning di restructuring and when Tinubu don  ready, him go proceed.

Order of the president

Mr. Onanuga com rivil say, “di President Tinubu don give all him ministers oda to talk about di activities of di present administration.

As him com dey highlight say di President don tell all ministers to engage with di media and di public to show di government’s efforts and successes.

But Som ministers dey shy to talk for media, and him wan make dem ova-com dis and actively comunikate dier achievements.

Di perception for pipo mind bi say di government no dey do enough, but for reality, dem don achieve plenty and na di ministers go publicize dier work.”

Regarding di petrol pricing issue, di Federal Government don clarify say dem no go interfere for di pricing face-off between NNPCL and Dangote Refinery.

Petroleum matter

Mr. Onanuga explain say since di petroleum market don deregulate, both entities dey free to set dier prices based on di market forces.

Dis deregulation allow both NNPCL and Dangote Refinery to operate independently and determine dier market prices, wey go benefit Nigerian consumers.

Mr. Onanuga com finally conclude say, “di government no go put mouth for di petrol pricing dispute between NNPCL and Dangote Refinery.

See also  Groups slam Tinubu's economic team, policies as worst since 1999

Both parties dey free to determine dier market prices, wey go benefit dem and dier consumers.”

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest from DDM TV

Latest Updates

INNOSON VEHICLE MANUFACTURING

CBEX restores wallet balances of subscribers

UK mum in tears as baby diagnosed with rare genetic condition that has no name

“No judiciary in 2027”: Nigerians reject courts over electoral injustice

Top High-Paying Nigerian Jobs Without University Degree in 2025

Man ends it after 12-year search for $742M lost Bitcoin hard drive

EU adds Monaco and 5 African countries to Blacklist for financial crimes, removes UAE

REVEALED: How Tinubu “killed” Jesutega Onokpasa

Open Letter to Atiku Abubakar on the Essence of Sacrifices

PDP bleeds as 12 lawmakers, govs defect to APC

Bellingham joins Borussia Dortmund in Record transfer deal

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks