Pidgin Corner
RCCG don suspend pastors wey dem accuse of homosexuality
Di Redeem Christian Church of God say afta dem accuse dem of homosexuality, Redeemed Christian Church of God (RCCG) don announce say dem suspend two ministers, Pastor Ayorinde Ade Bello and Deacon Oke Mayowa October 28, 2024.
According to report dem talk dis one for inside one internal memo wey date October 28 and na Pastor Sunday Akande, di RCCG National Overseer, sign am.
Pastor Akande don inform di church Special Assistant to di General Overseer on Administration say dem go temporarily relieve di accused from dem work as di church dey carry out investigation.
For di memo, Pastor Akande emphasize say RCCG dey committed to uphold biblical principles.
“Our mission dey deeply rooted for di teachings of di Bible, and we gatz address dis allegations wit di seriousness wey dem deserve,” na so him talk.
Di holiness-preaching church don dey firm for maintaining traditional interpretations of scripture, especially for moral issues.
Di RCCG stance on homosexuality dey based on passages like Leviticus 18:22, wey talk say same-sex relations na “abomination,” and 1 Corinthians 6:9-10, wey warn say di “unrighteous no go inherit di kingdom of God.”
For RCCG, to follow dis principles na core part of dem mission, Akande furdir talk.
Pastor Akande, however, don direct di Special Assistant to make sure say dem carry out thorough investigation on di allegations.
Him call make dem handle di inquiry wit confidentiality and respect for all di pipo wey dey involved.
him also talk say di church leadership don request make di investigation finish witin two weeks.
During dis period, Pastor Akande don direct Ade Bello, Mayowa, and any oda pipo wey dey allegedly involved make dem no participate for any church activities.
Pastor Akande make am clear say di suspension na precautionary measure, pending di outcome of di investigation.
“Dis mata na integrity and adherence to our values,” e affirm.
Dis no be di first time RCCG don face challenges wey relate to doctrinal adherence.
As one of Naija’s largest Christian organisations, RCCG don dey frequently address issues wey dem see as contrary to dem values, prioritizing discipline and strict adherence to dem interpretation of biblical morality.
Di outcome of di investigation dey expect to impact RCCG approach to similar issues wey go come in di future.
Di church handling of di mata fit serve as message to di global membership, reaffirming RCCG commitment to dem doctrines amid di evolving societal norms.
Di Redeemed Christian Church of God (RCCG)
Di Redeemed Christian Church of God (RCCG) is a holiness pentecostal megachurch and denomination headquartered for Ebute Metta, Lagos Naija.
E dey presence for 197 countries and territories of di world and e get more dan 5 million members for Naija alone.
Dis na one of di biggest church denominations for di world wit over 9 million members worldwide.
Afta di founder, Pa Josiah Akindayomi died since di year 1980, pastor E.A. Adeboye wey be di former university lecturer come be di General Overseer since di year 1981.
Adeboye na mathematics lecturer for University of Lagos and e don join di church since 1973.
Adeboye bin dey interpret Yoruba to English for Akindayomi sermons.
Dem ordain am pastor of di church for 1975.
Dem confirm am as di leader (wey dem dey call General Overseer) of di church for 1981, afta dem read Akindayomi sealed pronouncement posthumously.
For 1990, dem establish Redeemed Christian Church of God Bible School.
Andrew Rice, wey write for The New York Times, dey call di RCCG one of Africas most vigorously expansionary religious movements, a homegrown Pentecostal denomination wey dey crusade to become global faith.
Di church mission statement talk say For every household, go get at least one member of Redeemed Christian Church of God for di whole world.
For 2008, di RCCG get more dan 14,000 churches and five million members for Naija, and as at 2024, e dey present for more than 190 countries.
Di international church dey structured for different areas around di world.
Di local churches dey group into regions, with 59 regions wey dey Naija afta di 2024 Annual Convention of di church, wey happen for August.
E dey organised for most part of di world.
Notable special spiritual programs na di Holy Ghost Service, wey dey happen for di first Friday of every month for Naija. Others include di annual Holy Ghost Convention wey dey happen for August and di Holy Ghost Congress wey dey happen for December.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook