Connect with us

Pidgin Corner

Taiwan don close di case wey concern di papers wey explode for Lebanon for September

Published

on

Taiwan don close di case wey concern di papers wey explode for Lebanon for September

Taiwan talk say dem don finish di investigation wey dem dey do on di pagers wey explode for Lebanon wey cause wahala for Iran-backed Hezbollah, say no Taiwanese citizens or companies dey involved.

Israeli media report say Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu talk say na him get di responsibility for di attack during cabinet meeting.

E tell di ministers say senior defence officials and political figures no gree for di pagers to explode but e still carry di operation go ahead.

Security sources don talk say di pagers carry di name of Taiwan-based Gold Apollo, one company wey don talk say dem no make am.

Taiwan government don also talk say di pagers no be made for Taiwan.

Taipei prosecutors wey dey investigate di case don talk say di AR-924 pager model wey explode for Lebanon na Frontier Group Entity wey manufacture, trade, and ship am, and e no be made for Taiwan.

Dem add say Gold Apollo don authorize di company to use di Apollo trademark.

Dem no get evidence wey show say any local manufacturers or pipo dey involved for the explosions wey concern, wey go against the Counter-Terrorism Financing Act, or dey do any other illegal things, na wetin di prosecutors talk for statement.

No concrete evidence of criminal activity don show for dis case, and no specific pesin don dey involved for any criminal activity, afta dem do thorough investigation.

Prosecutors don confirm before say dem don question Gold Apollo president and founder Hsu Ching-kuang and one woman wey dem call Teresa Wu, di only worker for one company wey dem dey call Apollo Systems Ltd.

See also  Chinas Xi wan make dem get beta relationship wit Finland for green energy, peace plan for Ukraine

In dem statement, di prosecutors talk say Wu dey act as liaison with Frontier, but no evidence show say she get prior knowledge or don participate for any conspiracy or collaboration wey concern di explosion incidents.

Di prosecutors talk say dem get some information wey dem no sabi, including di exact identities of di Frontier employees wey Wu dey communicate with.

him talk say one pesin dem call and e be di head of Frontier.

While anoda pesin dem call M and e be di sales director.

Gold Apollo tell Reuters say dem don see di prosecutors statement, and say dem no fit talk more for now.

For May, di chief prosecutor for di International Criminal Court (no be di ICJ) don apply for arrest warrants against both Netanyahu and di din-Defense Minister Yoav Gallant, talk say dem get criminal responsibility for war crimes and crimes against humanity.

Netanyahu add: “We go continue to defend our country and our citizens for all fronts, against every threat, with di Iranian threat dey forefront.”

On Sunday, Israel advise im citizens make dem no attend sports and cultural events wey involve Israelis outside di country afta di attacks for Amsterdam.

For public advisory alert, Israel’s National Security Council (NSC) warn of alleged calls to “harm Israelis and Jews, under di guise of protest and demonstration.

“Dem dey use gadaring events (like sports and cultural events) to cause more harm and get media attention.”

 

 

 


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest Updates

Opposition leader Mahama returns as Ghana’s president

Peter Obi Donates ₦50M to Promote Education

Ademola Lookman Dazzles: Atlanta vows to keep “Their Star!”

Burkina Faso’s Leadership in Crisis: Government Dissolved

Babangida Aliyu Defends Tax Reform Bills, Slams Misinformed Critics

Ghana’s Presidential Election: Vote Counting Begins

Dele Farotimi and Chief Babalola: The many sides of the coin, by Adewale Adeoye

Presidential poll: Voting ends in Ghana, results trickle in

Rebels overthrow Syrian government, President Assad flees

Yuletide: Ikot Ekpene LG unveils 2024 Raffia City Christmas Village

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks