Pidgin Corner
Halima don beg Apostle Suleman for di lie wey she lie for him head
Nollywood actress Halima Abubakar don come give wetin be like heartfelt public apology to di General Overseer of Omega Fire Ministries, Apostle Johnson Suleman for defamation.
According to report, di big actress diva Halima don admit say she bin dey spread false information about di prosperity preacher and e dey cause am big distress.
Halima Abubakar wey dem born for Kano State but e be pesin wey come from Kogi State.
She go Ideal primary school for Kano, den she study Sociology for Bayero University, Kano State.
For October 2018, Abubakar talk say she still be virgin.
She start to act for 2001 wen she play small role for Rejected.
Her first lead role na for Gangster Paradise.
She also be di CEO of Modehouse Entertainment, wey be music label and entertainment management company.
Curvaceous Nollywood actress, Halima Abubakar, get wetin fit make plenty men dey misbehave and dey act funny.
But as dem dey talk, pesin wey fine fit deceive you, and instead of plenty welcoming smiles, you fit just end up wit goose pimples or even red eye bicos dis sexy babe no dey vulnerable at all.
But even di serious Halima go agree say as dose ‘stop’ signs dey shine for her eyes, some die-hard randy men still dey try di luck to see if dem fit enter easy street wit her.
“Wetin I go talk if I say nobody don harass me? I be woman.”
“E no bi true wen pipo dey talk say dem neva experience harassment,” she talk.
“As woman, you gatz respect yourself and set boundaries no mata wetin pipo dey think.”
“Some pipo dey think say if dem sleep wit pesin, e go give dem wetin dem dey find, but e no go work. “
“Na so I dey see life. You no suppose do anything (sleep wit pesin).”
“So wetin I dey do be say, I go look di pesin face and tell am say dis one no correct, bicos I sure say apart from me, e go still harass anoda pesin.”
“Di only easy way na to disgrace di pesin so dat e go dey shy to do am to di next pesin.”
“My dear, I no dey here to joke, neidir I dey here to be rude to anybody. But you know, you go meet some very rude pipo wey no sabi how to talk.”
“So wen you meet such pipo, you go just give dem back. You go raise your voice and embarrass dem, dem no go try am again.”
“I fit embarrass you well well wen you dey randy wit me and dey try to harass me.”
Today she don come give public apology for inside statement wey she post for her official Instagram page on Wednesday.
Halima Abubakar don express deep remorse for di harm wey she don cause to di Pator Suleman’s reputation, she dey hope say di apology go help reduce di damage wey don happen already.
Di statement talk say, “I dey write you dis letter to acknowledge di falsehood wey I talk about you for social media and to offer my sincere apologies.”
“Afta I don reflect well, and make my conscience for take align wit God, I don realize di depth of di harm and distress wey my lies don cause you.”
“I admit say I don make false allegations against you and I dey regret my action and di damage wey I don cause you, your wife, Dr. Lizzy Suleman, your family and di leaders of di Omega Fire Ministry.”
“Wit dis letter, I dey humbly ask for forgiveness, I sabi say my apology no fit undo di harm, pain, and distress wey I don cause”
“But I dey ask you to find place for your heart to forgive me as I no bin dey think well dat time.”
“Sir, you don do plenty tings for humanity, abeg extend your hands of forgiveness towards me.”
“Once again, sir, I dey truly sorry for all di hurts and distress wey I don cause you, your family, and ministry.”
“Thank you plenty, and make di heavens calm your heart. God bless you, sir.”
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook