Pidgin Corner
IPOB don ban celebration of Naija’s 64th Independence Day
Di Indigenous People of Biafra don bann di celebration of Naija’s 64th Independence Day in the South-East region on as Naija dey prepare to celebrate Independence Day for October 1, 2024.
Di spokespesin of di Imo State Police Command, ASP Henry Okoye, com respond.
ASP Okoye talk on September 30 say dem go do joint security operation to mek sure say di Independence Day celebration go dey safe and peaceful for di whole state and to stop any wahala wey fit happen during and afta di event.
Dem position security pipo dem for strategic points across 27 LGAs mek dem for take ensure peaceful celebration an prevent wahala.
Commissioner of Police, Mr. Aboki Danjuma, don collaborate wit oda security agencies to mek sure say everytin dey go wella.
As e com bi, Joint patrols and confidence-building measures dey ongoing to tek prevent criminal activities an mek citizens feel safe.
Recently, IPOB/ESN militia group threaten say dem go must to disrupt celebration.
But Police Command com first dem establish robust security measures to tek address potential risks.
Na e im com advised di citizens say mek dem remain vigilant an mek dem report any suspicious activities giv nearest Police Stations.
Dis no bi first tym IPOB dey threaten peace for Imo State.
Gunmen kill four policemen an POS operator over sit-at-home orda inside July.
Police no go tek am lightly dis tym around.
Dis Security Measures Include:
- Joint Patrols: Police and oda security agencies dey patrol strategic points to prevent criminal activities.
- Confidence-Building Measures: Dem dey tek steps to tek reassure citizens of dia safety.
- Robust Security Measures: Police Command don establish special security measures to tek address IPOB/ESN threats.
Dem declare say anybody wey participate for any activity to mark Independence Day go be considered enemy for di land.
Dem say mek Igbo pipo just dey go about dem normal business or stay for house if dem want.
But dem no go fit do anyting to mark Naija’s independence.
IPOB insist say even though Igbo pipo contribute to Naija’s independence struggle, di union don harm dem plenty.
Dem com advise Igbo pipo say dem must to reject Naija’s “forced unity” and work towards restoring Biafra’s independence.
No Naija flag go fly for Biafran territory, and no independence celebration for students.
IPOB warn parents and guardians say mek dey no allow dem children participate in any Naija independence activities, as dem dey monitor di situation for Biafraland.
Dem min business, and anybody wey disobey go regret am.
IPOB don sen message to remind Biafrans wey dey home and abroad say dem no go celebrates Naija’s Independence Day, October 1st, again.
Dem say mek Biafrans avoid anyting wey relate to Naija’s independence celebration worldwide.
Dem talk say Igbo pipo sufa plenty for wi country Naija, yet Naija no appreciate dem.
IPOB say dem reject Naija’s “forced unity” and go focus on getting Biafra’s independence.
Wetin IPOB Want:
- No Biafran should celebrate Naija’s Independence Day
- No Naijan flags should be flown in Biafran territory
- Biafrans should either stay indoors or go about their normal business on October 1st.
IPOB com warn parents and guardians to no allow their children participate in any Naija independence activities, as dem dey monitor di situation for Biafraland.
IPOB dey call on all Biafrans worldwide to just dey go about dem normal business.
Since dem no bi part of Naija again and no get anyting to do wit Naija’s independence wey dem get from Britain for 1960.
Dem know say som prominent Igbo pipo play big role to secure Naija’s independence wey dem dey celebrate every October 1st.
But dat independence don cost Ndigbo more blood than any other ethnic group for wi country Naija.
IPOB dey tell Biafrans say dem don decide to reject Naija’s “bloody flag independence” an work towards restoring a united and prosperous Biafra.
Dem say mek every Biafran reject Naija’s forced unity and look forward to celebrating Biafra’s own independence soon.
IPOB no dey joke about dis one, o.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook