Connect with us

Pidgin Corner

Poverty and unemployment na di cos of Insecurity for Africa

Published

on

Poverty and unemployment na di cos of Insecurity for Africa

Poverty and unemployment na di cos of insecurity for africa, as Mr. Peter Obi, di 2023 Labour Party presidential candidate, don com yarn for di Athens International Dialogue on Sunday, September 29, 2024.

Na for one press statement wey Mr. Ibrahim Umar, POMR Spokesman, release Mr. Obi talk dis one for di Athens International Dialogue, wey be gathering of global leaders.

Mr. Obi don talk say all di insecurity wey dey Africa dey linked to poverty, unemployment, corruption, and inequality.

“I join global leaders for one Leadership Dialogue wey focus on governance, especially for security and economy for today world, and di lessons for future leaders,” na wetin Mr. Obi talk.

Mr. Obi com still yarn say, him don still com observe say “for Africa, we dey face high level of insecurity, serious corruption, worsening poverty, plenty youth dey unemployed, and big inequality full ground.”

“Over 50% of di world pipo wey dey suffer multi-dimensional poverty dey live for Sub-Saharan Africa.

Nigeria and Congo get over 60% of dia population wey dey live for poverty and dey suffer from unacceptable level of inequality,” na so him talk.

Mr. Obi, wey bi Leader of di Labour Party, Nigeria; yarn dis one for one Leadership Conference for Athens, Greece, yesterday wit Mr. Andres Pastrana, Former President of Colombia and Adalberto Costa Junior, President of UNITA, Angola,

E com emphasize say urgent action dey needed for dis mater, say “future African leaders dem must take bold, accelerated, just, and transformative actions wey go help dem to achieve far-reaching and beta, people-centered development results.”

See also  N110.4b fraud: Court don issue public summon for Yahaya Bello

Di Athens International Dialogue com bring togeda for one place former presidents, prime ministers, serving and retired senior government officials, military chiefs, renowned academics, and sports personalities as dem discuss global governance challenges.

Gory statistics

Com mek di pipo know say, Africa dey face serious development challenges, wit poverty, unemployment, and corruption wey di form one vicious cycle wey dey hinder economic growth and dey spoil human well-being.

Di Poverty problem for Africa

Over 736 million Africans dey live for extreme poverty, wey be 60% of di world poor pipo.

According to World Bank report say 413 million Africans dey live on less than $1.90 a day since 2020.

Sub-Saharan Africa get di highest poverty rate, wit 40% of di population dey below di poverty line.

Countries like Burundi (74%), Central African Republic (71%), and Democratic Republic of Congo (63%) get di highest poverty rates.

Unemployment: di Ticking Time Bomb

Africa youth unemployment rate dey 13.4%, wit 75 million youth dey unemployed or underemployed. North Africa youth unemployment rate high reach 29%.

Countries like South Africa (34%), Nigeria (23%), and Egypt (22%) get significant youth unemployment rates.

Di African Development Bank estimate say Africa nid to create 12 million jobs every year to absorb new pipo wey dey enter di labour market.

Corruption: di Major Obstacle

Corruption dey everywhere for Africa, wit di continent dey lose $89 billion every year to illicit financial flows.

Transparency International Corruption Perceptions (TICP)  Index 2022 rank 44 African countries below 50 out of 100, wey dey show high corruption levels.

See also  NLC yarn FG say dem must to reverse pump price sharp-sharp

Countries like Somalia (13), South Sudan (13), and Yemen (15) dey among di most corrupt for di world.

Corruption dey spoil economic growth, dey discourage investment, and dey make poverty worse.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest Updates

FG don increase price for number plates and driver’s license

First lady donates One Billion Naira for restoring OAU horticultural landscape

NLC yarn FG say dem must to reverse pump price sharp-sharp

Lady claim say she get belle for Burna Boy afta 3 years releatioship

Atiku labels Tinubu “TPain”

NDLEA cancels married women husband’s approval to travel out.

Why I no talk to Bisho Oyedepo again

Editorial: “Go to court!” – Can CJN Kekere-Ekun redeem the judiciary’s integrity?

Economic wahala: Chibuike Rotimi Amaechi say him dey vex

South Korean author, Han Kang wins 2024 nobel prize in literature

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News