Pidgin Corner
Israel Netanyahu don accept say dem attack pager, e talk say e dey see ‘eye-to-eye’ with Trump on Iran
Israel don confirm for di first time say na dem dey behind di operation wey happen for September to blow up plenty pagers wey Hezbollah dey use for Lebanon.
Di Israeli media report on Sunday say Prime Minister Benjamin Netanyahu tell im cabinet say.
“Di paper operation and di elimination of (Hezbollah leader Hassan) Nasrallah start even though senior officials for di security and political side wey dey in charge no gree am.”
An Israeli official don confirm dose remarks to CNN na di first time Israel don accept say dem get hand for di mata.
Di decision wey di government make to brief Israel media on Netanyahu remarks and by extension, confirm say Israel dey behind di operation.
E be like say na anoda chapter for di domestic political wahala wey don dey happen for Israel for di past weeks.
Israeli media don interpret di way dem talk as implicit criticism of Israel military leadership and intelligence pipo, as well as di former Defense Minister Yoav Gallant, wey Netanyahu fire on Tuesday.
Di Israeli government dey face plenty criminal investigations, including say dem dey leak false intelligence reports to international media.
Di Prime Minister Office talk say dem no do anything wrong.
On September 17, plenty explosions hit Hezbollah members, dem target di pagers and den walkie-talkies one day later.
Di blasts kill at least 37 pipo, including some children, and injure nearly 3,000, many of dem na civilian bystanders, according to Lebanese health authorities, many of dem na civilian bystanders.
Di day afta dem start to dey blast pager for Lebanon, Gallant seem to sabi wetin him country dey do.
“Di IDF dey bring beta achievement, togeda with Shin Bet, togeda with Mossad, all di bodies and all di frameworks and di results dey very impressive,” him talk for September 18.
Wen him visit Ramat-David Air Force base for northern Israel. ‘Very good’ talk with Trump.
Di acknowledgment of di pager attack come as Netanyahu talk say him don yarn three times for recent days with US President-elect Donald Trump.
Speaking before cabinet meeting wey happen on Sunday, Netanyahu talk say: “Dis one na beta and important talk, wey dey aim to make di strong alliance between Israel and United States beta.”
E add say: “We dey see eye-to-eye on di Iranian threat for all di levels and di danger wey e dey bring.”
“We also dey see di big opportunities wey dey before Israel for peace and expansion, and for oda areas.”
Netanyahu also talk about wetin happen for Netherlands last week, wen Israeli football fans face antisemitic abuse and violence.
“We no go eva allow di wahala of history to happen again.”
“We no go surrender to antisemitism or terrorism,” Netanyahu talk.
“E get one clear line wey connect di two recent antisemitic attacks wey happen for Israel for Dutch land.”
“Di criminal legal attack on di State of Israel for di International Court of Justice (sic) for Di Hague, and di violent criminal attack against Israeli citizens for di streets of Amsterdam,” Netanyahu talk.
For May, di chief prosecutor for di International Criminal Court (no be di ICJ) don apply for arrest warrants against both Netanyahu and di din-Defense Minister Yoav Gallant, talk say dem get criminal responsibility for war crimes and crimes against humanity.
Netanyahu add: “We go continue to defend our country and our citizens for all fronts, against every threat, with di Iranian threat dey forefront.”
On Sunday, Israel advise im citizens make dem no attend sports and cultural events wey involve Israelis outside di country afta di attacks for Amsterdam.
For public advisory alert, Israel’s National Security Council (NSC) warn of alleged calls to “harm Israelis and Jews, under di guise of protest and demonstration.
“Dem dey use gadaring events (like sports and cultural events) to cause more harm and get media attention.”
NSC talk say dem planned attack fit happen for Belgium, United Kingdom, and France.
Dem tell Israelis make dem avoid di France-Israel football match wey go happen for Paris on Thursday.
Israelis don also dey warned make dem stay away from protest and demonstration and make dem “take extra care to hide any Israeli/Jewish symbol.”
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook