Connect with us

Pidgin Corner

Oga Biden no wan mek Israel destroy Iran nuclear program

Published

on

Oga Biden no wan mek Israel destroy Iran Nuclear Program

Oga Joe Biden, wey bi US President, on Wednesday, 2, 2024 talk say im no dey support di destruction of Iran’s nuclear facilities, and him wan find pisful solushun to di mata.

Iran don fire ballistic missiles enter Israel on Tuesday, as tension dey rise for Middle East, according to many reports Wednesday, 2, 2024

Dem say around 200 missiles dem fire, and dat one com bi lik say na first wave of attack, according to Reuters and Axios’ Barak Ravid.

Iran don dey vow for months say dem go retaliate against Israel bicos of di many asasinashuns wey dem do against dem terror leaders.

And Hamas leader Ismail Haniyeh and Hezbollah leader Hassan Nasrallah.

Wetin dey cos di problem be say Israel don dey attack Iran leaders and facilities for some time now.

On July 31, 2024, Israel attack Hamas leader, Ismail Haniyeh for Tehran, Iran.

On September 27, 2024, Israel also attack and kil Hezbollah leader, Hassan Nasrallah, for Beirut.

Iran com si di attack as declaration of war and promise say dem go retaliate.

Now, di situashun dey very tense, and many countries dey condemn di attack.

US don vow say dem go mek sure say Iran face consequences for di attack.

Di whole ting dey cos fear say war fit break out for Middle East.

Avi Melamed, former Israeli intelligence official com talk say dis Iranian strike against Israel for nite bi lik say Iran wan’ tek bak im power, and maybe na desperate move to stop Israel from attacking Hezbollah wey bi Iran ally.

But, di way Iran launch di missiles don cos tension to rise well well, and now di whole ting don nearly turn to regional conflict wey Iran no fit win.

Hezbollah bin dey fire rockets enta Israel since morning, and den Iran join, com cos air raid alerts to dey blow all ova Israel.

Israel get di Iron Dome defense system wey dey colect drone and missile attack.

But dis tym, videos from different places show say som missiles enta Israe.

See also  Iran's missile attack: Looming Israeli response and its far-reaching implications

Biden say im don dey find di way im wan tek resolve di issue wey no go involve violence.

Temporary Solushun:

im wan Iran gree say dem must to limit tdia nuclear program, even sef to stop di accumulation of enriched uranium, say dem no go produce weapons.

Biden administration dey try balance tings for Middle East, and dem no wan mek Israel and Iran fight.

Say mek we dey watch how tings go be, but say for now, Biden no gree say mek Israel s destroy Iran’s nuclear program.

Oga Joe Biden, US President, talk say im no dey in support for how Israel tek dey attack Iran nuclear sites as revenge for di missile wey Iran launch Tuesday.

Iran launch di missile as payback to Israel bicos dem kil som top officials wey Iran dey bak, according to Associated Press.

Biden com talk say Israel get right to retaliate, but im no agree wit strike on Iran nuclear sites.

im wan find pisful solushuon to di mata.

Di situashun dey tense for Middle East, and mani countries dey fear say ting go escalate.

Wetin cos di problem

  • Israel kill some top Iran-backed officials
  • Iran don launch missile strike against Israel
  • Israel wan follow launch dia own missile.
  • Iran launch missile barrage against Israel as payback
  • Israel wan retaliate, but Biden say no to attack on nuclear sites Di US President dey try balance tings, mek pis return to di region.

But Iran and Israel stil dey exchange blows

President Joe Biden talk say “no” to reportas bifor im enta Air Force One, as dem ask am if him support Israel attack on Iran’s nuclear sites.

im dey oppose any strike on Iran’s nuclear facilities, even though Iran first launch dia own missile barrage against Israel.

im  com talk say im know say Israel get rite to retaliate, but dem must to do am proportionally.

Biden dey try calm down di situashun, mek pis for return to di Middle East.

See also  Rivers State House of Assembly don declare seats of four members vacant, oh!

Im say implant na to talk to Prime Minister Benjamin Netanyahu and oda G7 leaders to find di way forward.

Di whole ting start wen Iran launch missile strike against Israel, and now Israel wan retaliate too.

Oga Biden talk say im go lik to dey discuss wit Israeli government mek im for tel dem wetin dem go do.

But all di G7 leaders agree say Israel get right to retaliate, and if dem wan mek dem do am proportionally.

But Biden com min say Israel fit respond, but dem no suppose ovado am.

Di G7 leaders dey fully dey support Israel’s rit to self-defense, but dem also wan mek sure say di situashun no escalate pass as e com bi.

G7 leaders support Israel’s right to self-defense, but wan proportional response.

Biden and oda G7 leaders dey work togeda to find way forward, mek pis for return for di region.

Oga Biden and im plenty allies don dey struggle to mek Netanyahu calm down wit im military responses, as dem dey fear say Israel’s war go com bring plenty countries join di fight.

Na so Iran don attack Israel twice dis year, and di second attack wey happen on Tuesday, kil only one persin.

US officials dem com yarn say di Tuesday strike bi almost big pass di first one wey happun inside April.

Di situashun dey very tense, plenti pipo don dey fear and n aim mek Oga Biden wan mek sure say Israel no go escalate di mata.

Dis Iran’s attack on Israel  so na retaliation for di Israeli airstrike on Iranian consulate in Damascus, Syria.

Di whole ting start wen Hamas, wey be Iranian-backed militant group, attack Israel in October 2023, kill ova 1,200 pipo

Dem warn Iran say dem no go tolerate any more attacks, and dem also tell Israel say dem must to dey careful wit dia military responses.

Oga Biden com tell reporters say “we must to avoid am” before him enta Air Force One to return to Washington.

See also  US: nobody dey care about Prince Harry or him no popular wife Meghan Markle-Eric Trump

But im no specifically menshun wen im go like yarn wit Netanyahu, but tension dey rise well for di region.

Israel don launch airstrikes wey don wipe out most of Iran-backed Hezbollah’s command structure, and di ogaji, Hassan Nasrallah.

Hezbollah don confirm say Nasrallah and oda top officials die for Israeli airstrike.

E bi like say Biden administration dey happy about di airstrike wey kil Nasrallah, dem call am “measure of justice”

Wetin Oga Biden write for statement:

“Hassan Nasrallah and di terrorist group him lead, Hezbollah, don kill hundreds of Americans for over 40 years of terror.

Him death from Israeli airstrike be justice for him many victims, including thousands of Americans, Israelis, and Lebanese civilians.”

Biden wan mek sure say Israel no go fit to escalate di mata.

Oga John Kirby, wey bi White House National Security Communications Adviser (WHNSCA), com dey yarn on Sunday say Israel airstrikes wey target Hezbollah leadership bin gud for di world.

Im com emphasize say preventing regional war dey very important.

Kirby talk say, “Hezbollah command structure don scata, and dat one favor Israel.

Say E good for di region, good for di world”.

Oga Biden also talk on Saturday say im ultimate goal be to “de-escalate” fighting for Lebanon and Gaza through diplomatic mins.

Pipo dey condemn di attack as di situashun com dey very tense for many countries

Oga Biden com talk say, “na tym to settle dis mata bi dis and to stop di threats wey dey face Israel, and to bring about pis to di whole Middle East region”.

Dat one min say im wan mek everyting calm down, no more fight, no more threats, mek everybody for lif in pis.


For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Latest Updates

Nigerian soldier arrested for smuggling, selling ammunition to bandits

Tinubu’s tragic trial of Nigeria’s malnourished minors — by Farooq Kperogi

WHO sends almost a million Mpox vaccines to Africa

Fainting in court: Kid prisoners acted drama to attract pity -IGP

Victor Osimhen sets new Galatasaray record

Ballon d’Or: Vinicius is disrespectful -UEFA President

NAFDAC issues warning on sales, distribution of unregistered condom

Ten years since Compaoré’s overthrow: Burkina Faso’s decade of turmoil

Locked for Mideast war and dey suffer from sanctions, Iran dey careful about US presidential election

Meet Prof Kindiki, Kenya’s new deputy president

Subscribe to DDM Newsletter for Latest News

Get Notifications from DDM News Yes please No thanks