Pidgin Corner
Putin’s press conference: Ukraine, Trump, Biden, Syria

Following di press talk na some of di key quotes from Russian President Vladimir Putin’s annual phone-in and press conference.
For him 25 years for power, I think say I dey do more than just safeguard (Russia).
I think say we don move back from di edge of di abyss, bicos everything wey happen to Russia before and afta dey lead us to complete and total loss of our sovereignty.
And without sovereignty, Russia no fit exist as independent state.
I don do everything to ensure say Russia dey independent and sovereign power wey fit make decisions for dia own interests, and not for di interests of dose kontri wey dey drag am towards demselves, patting it on di shoulder, in order to use am for dia own purposes.
We maintain relations wit all di groups wey dey control di situation for dire, wit all di kontri for di region.
Di ova-whelming majority of dem dey tell us say dem go dey interested for our military bases remaining for Syria.
You wan portray everything wey dey happen for Syria as some kind of failure, a defeat for Russia.
I assure you say e no be so. Who-eva wan to dey portray Russia as weakened, you go know.
I go like recall famous pesin and writer wey once talk “Rumors of my death bin dey greatly exaggerated”.
Di main beneficiary of di event wey dey take place for Syria for my opinion na Israel.
We hope say Israel go at least at some point leave Syrian territory.
But now e dey bring in more additional troops for dire.
I think say dem dey already plenty for dire. And I get di impression say not only dem no go leave, but dem go reinforce dire.
Well, first of all, I no know wen we go meet bicos him no talk anything about am.
I neva talk to am at all for more than four years. And I dey ready for dis, of course, for any time.
And I go dey ready for meeting if him want am. And if meeting take place for some point wit di newly elected president, Mr Trump, I dey sure say we go get plenty to talk about.
Biden Pardoning him son
E dey always important say you dey more of a politician or more of a human being?
E turn out say Biden dey more of a human being. I no go blame am for dat.
For how Putin don change since di war take start
Dis three years of course na di serious test for all of us, for di whole kontri and for me, I begin to joke less, and almost stop to laugh.
For di willingness to negotiate wit Ukraine
We don always talk say we dey ready for negotiations and compromises, di mata na just bicos say di oda side, both literally and figuratively, refuse to negotiate.
So, Soon, dose Ukrainians wey wan fight go run out, for my own opinion, soon dem go get no one wey go remain wey go wan fight.
We dey ready, but di oda side need to dey ready for both negotiations and compromises too.
We no need truce, we need peace, long-term, secured by guarantees for di Russian Federation and its citizens.
For di end of di deal wit Ukraine for di movement of Ukraine gas
Ukraine don refuse to extend di movement contract, but no be us wey refuse, na Ukraine wey refuse, although e dey receive somewhere between $700-800 million per year.
Dis contract no go exist, everything wey dey clear now.
Well okay, we go survive. Gazprom go survive dis.
For Russia new Oreshnik hypersonic missile
Dem no go get chance to take shoot down dis missiles.
Make Western experts propose to us, and make dem propose to dose for di West and di U.S. wey dey pay dem for dia analysis, to take conduct some kind of technological experiment, say, high-tech duel of di 21st century.
Make dem determine some target for destruction, say for Kyiv, concentrate all dia air defence and missile defence forces dire, and we go fire dire wit Oreshnik and see wetin go happen.
We dey ready for such experiment, but di oda side dem dey ready?
For di war for Ukraine
I go talk say di situation for di front dey change dramatically.
dem dey move along di entire front line, every day. And we dey move, as you talk, towards solving our primary tasks, wey we outline for di beginning of di special military operation.
Everyone dey fight, literally heroically. And dem dey fight right now. Make we wish dem all, both dose wey dey fight for di Kursk region of Russia and dose wey dey fight along di entire front line, good luck, victory and to return home.
For di economy
For Russia di situation dey normal, stable, we dey develop despite everything, despite external threats and attempts to take influence us.
Of course, inflation dey and e dey give very alarming signal.
Dem get some issues here, like, inflation, certain ova heating of di economy, and di government and di central bank don already dey task wit bringing di tempo down.
dem get some subjective reasons for rising prices, and dem get some shortcomings for our part.
For example, some experts believe say di central bank fit don start to use certain tools wey no dey relate to di raising of di key rate more effectively and earlier.
Yes, di central bank start to do all dis some wia for di summer, but, I repeat, dese experts believe say dis fit and suppose don dey done earlier.
Dis na very unpleasant and bad thing, in fact, di rise in prices.
But I hope say in general, while maintaining macroeconomic indicators, we go cope wit dis too.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook