Pidgin Corner
US-Big win: Trump don make historic as him comeback for White House
Donald Trump don seal historic victory for US presidential election and him don complete him stunning political comeback.
Di Republican comfortably beat Democrat Kamala Harris for wetin polls don suggest go be tight election, afta him sweep plenty key battleground states and win big for di national popular vote.
Him don become di first former president wey go return to di White House for more than 130 years and, at 78, di oldest man wey don dey elected to America highest office.
Some claim say him don win for rally for Florida on Wednesday morning.
Trump tell him supporters say him go bring “new golden age” come and restore America to greatness.
Him dey wit him family and him choice for vice-president, JD Vance.
Trump tell supporters for West Palm Beach on Wednesday morning: “Dis na big victory for American pipo wey go allow us make America great again.
Di work wey dey before us no go easy, but I go bring every energy, spirit and fight wey I get wit my soul come do di job wey una don trust me wit.
Elon Musk, di richest man for di world and Trump big donor, dey wit di Republican candidate as di results dey come.
Di billionaire post positive messages for X – wey him get – throughout di night.
Trump don sweep plenty of di key battleground states, wit CBS dey project say e don win for Pennsylvania, Wisconsin, Georgia and North Carolina.
And e dey look like say e go fit carry all di seven swing states wey important for win.
Projections dey show say e likely go win di overall popular vote for di country.
Something wey e no fit do wen e first win for 2016.
Trump still get solid lead for Nevada, while di race dey tight for di other Sun Belt battleground of Arizona.
As wey dem expect, Trump don dominate conservative strongholds from Florida to Idaho, while Harris don win liberal states from New York to California, CBS dey project.
Dem bin expect say di Democrat go address crowd for election night for Howard University for Washington DC, wia she bin dey study, but afta midnight, e don show say she no go appear.
Following di announcement wey Democratic campaign co-chairman Cedric Richmond make, di crowd just disappear from Harris HQ for di historically black college.
CBS exit poll data show say Vice-President Harris wey dey hope to become America first woman president and campaign well for abortion rights fit don under-perform wit women.
Some 54% of female voters cast their votes for her, di numbers show.
But Joe Biden win di support of 57% of women for 2020.
Black and Latino voters also seem say dem no too likely to support Harris like how dem support Biden four years ago, according to Associated Press exit poll data.
Instead, Trump carry di key battleground states and scatter di Democrats once strong Blue Wall of Wisconsin and Pennsylvania, wit Michigan also dey lean hin way.
He don become di oldest man wey go take di presidency.
Di Republican don refuse to release im medical records, even though e don spend plenty of im early campaign to attack President Joe Biden wey dey grow old.
Congress dey also up for grabs for di election.
If e happen say Trump go get major boost for im presidency, Republicans don win control of di Senate afta dem take two seats for West Virginia and Ohio from di Democrats and don see off one competitive challenger for Texas.
Neither party no seem to get overall edge for di House, wey Republicans dey control small-small.
But, if dem get control of Congress, e go allow Trump to get easy way to pass im key proposals through di legislature, including im promises to enforce mass deportations of illegal migrants and to carry out big tax cuts.
He don promise say e go change federal government well well e go fire plenty career civil servants and replace dem wit political appointees.
For im rally for Florida, Trump talk say e don win one kind unprecedented and powerful mandate to carry out dat agenda.
About 86 million voters don cast dem ballot early during one of di most turbulent campaigns for American history.
Harris, 60, only become di Democratic Party candidate for July, afta President Joe Biden witdraw from di race because of pressure from inside di party.
Trump na di target of two assassination plots – e narrowly escape sniper bullet for Pennsylvania for July.
Him victory na big change for di billionaire.
Him come out for office for 2021 wit approval ratings wey don fall and di country dey shake afta di Capitol riot wey him supporters try to use violence block di certification of him loss to Joe Biden.
Him just manage escape conviction for di Senate afta him be di first president wey dem impeach twice by di US House.
Di Republican leader for di Senate Mitch McConnell talk say Trump don provoke him supporters to attack di Capitol.
Later, him become di first former president wey dem convict for criminal matter, afta dem find am guilty for 34 counts of falsifying business records.
But him announce say him go return to frontline politics for November 2022, start di campaign wey go eventually make am clear away challengers for di Republican primaries and collect him party nomination for president.
Him campaign for White House don dey fight for clear terms, dey attack him opponents first President Joe Biden, the Harris for personal terms.
E dey often repeat him false claims say dem steal 2020 election from am, Trump don vow to him supporters say e go be their justice and retribution if dem return am to office.
E still paint picture of US as country wey illegal immigration don overrun and wey economy dey crumble.
Attention go turn to how him potential cabinet go be in the coming days, as senior advisers dey tell CBS say Trump transition team go meet for West Palm Beach for the coming days.
for him victory rally, Trump talk say Robert F Kennedy Jr wey be former Democrat and vaccine-skeptic go get important healthcare role.
Him go help make America healthy again, Trump talk. Him wan do some things, and we go allow am make e do am.
Both sides get plenty lawyers wey dey ready for legal wahala on top election day and afta.
Even though Trump campaign don file some early lawsuits, the way him dey lead no show say wahala go fit happen.
Law enforcement agencies for everywia dey alert for any possible violence, but everything don dey peaceful so far.
About 30 bomb threats hoaxes don target election-related places for everywia on Tuesday, more than half of dem for Georgia alone, CBS report.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook