Pidgin Corner
NDLEA don arrest Canada-based nurse for drug trafficking

National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don arrest One Canada-based nurse, Usman Grace Khadijat Olami, and two businessmen, Ihejirika Okechukwu Emmanuel and Iwuagwu Ikedi Victory on October 21, 2024, for Murtala Muhammed International Airport Ikeja, Lagos as dem dey try to import and export cocaine pellets and parcels of Loud, wey be synthetic strain of cannabis through diairport.
According to report, Ihejirika wey dey go Thailand wey him claim say na from dere him dey import fish come Naija, dem arrest am on Tuesday 15th October 2024 as him dey try to board Ethiopian Airlines flight go Thailand through Addis Ababa, Ethiopia.
Wen dem carry am go do body scan, diresult show say him don swallow illegal drug wey turn out to be cocaine.
As e be so, dem put am under observation wey him go fit excrete, and during dat time, him come expel five big egg-size wraps of cocaine wey weigh 400 grams.
For di statement wey dispokesman of di anti-drug agency, Babafemi Femi talk say, di 51-year-old suspect confess say dem go pay am wen him deliver di drug for Thailand.
Him talk say him need di money to boost him fish importation business.
For di same mata, NDLEA operatives for Lagos airport on Thursday 17th October catch one 26-year-old businessman Iwuagwu Ikedi Victory wey dey come from Brazil through Addis Ababa during di inward clearance of passengers on Ethiopian Airlines flight.
Him body scan show say him don swallow illegal drugs.
Wen dem put am under observation, him come excrete one pellet of cocaine wey weigh 22 grams.
But him confess say him swallow 30 wraps of di illegal drug for Brazil but come excrete 29 pellets for Addis Ababa, wia him give another pesin.
Di suspect talk say dem go pay am N2.5 million for trafficking di drug.
Meanwhile, dem arrest miss Grace di Canadian nurse on October 4, 2024, by NDLEA officers for Lagos airport during di inward clearance of Air France passengers wey come from Toronto, Canada through Paris.
During search of her luggage, dem recover total of 70 parcels of Canadian Loud, wey weigh 35.70kg from her.
During her interview, she talk say she dey Naija to meet her boyfriend wey instruct her to come wit di big consignment of di highly sought-afta synthetic cannabis.
dis arrests na part of di effort wey NDLEA dey make to fight drug trafficking for Naija.
NDLEA don dey carry out raids and arrests across di country, dey seize large quantities of illegal substances, including opioids and cannabis.
NDLEA operatives “At di seaports, dem intercept total 162,351 bottles of codeine-based syrup from two containers for di Apapa seaport for Lagos.
During di joint examination wit di men of di Customs Service and other security agencies on Tuesday, October 15.
No less than 7,200,000 pills of Royal 225 mg Tapentadol and Carisoprodol wey worth N3,600,000,000 for di street value, dem seize am from one watch-listed container wey come from India for Port Harcourt Port Complex, Onne, Rivers State on Tuesday, 15th October.
“For di same container, dem recover 780 cartons of chlorphenamine wey get 15,600,000 pills of di opioid.
From two other watch-listed containers wey dem search for di port for Onne, dem recover total 337,000 bottles of codeine-based syrup wey worth N2,359,000,000 from dem on Tuesday 15th and Thursday 17th October.
Dis one bring di total value of di seized Tapentadol, Carisoprodol, and Codeine consignments for di two seaports to N7,095,457,000.
“For Bauchi state, one di suspect, Mr. Sunday Jonathan Ogenyi, 33, dem arrest am along Bauchi-Jos Road wit 76,600 pills of tramadol.
Dem hide for false compartments of him Toyota Sienna vehicle wey get number plate JRV 341 ZY, while NDLEA operatives for Ondo state on Tuesday, October 15.
Dem arrest three suspects: “Goddey Obizuo, Samuel Aniete; and Kuffrey Aniete for Afo village where dem seize 672kg cannabis sativa from dem.”
“One raid for Illushi Forest for Esan South East LGA, Edo State, lead to di destruction of 10,590.36 kg cannabis wey spread for 4.236144 hectares of farmland.
Suspects wey dem arrest during di operation include Benson Upuoni, 65; and Sunday Nwaeboyi, 35.
“For Lagos, NDLEA operatives on Tuesday, October 15, dem arrest Andrew Joseph Anoriode wit 3 kg methamphetamine and 1.90 kg cannabis along Lagos-Ibadan expressway, while 241 kg of di same substance dem recover for Gbaji, Badagry area of di state.
“One suspected meth cook, Agbeiboh Oscar, dem catch am di same Tuesday for Abule Osun wit 265 grammes of methamphetamine and different quantities of di precursor chemicals for di manufacture of methamphetamine and others.
“Wit di same energy, commands and formations of di agency across di country continue dem War Against Drug Abuse, WADA, and sensitisation activities to schools, worship centres, workplaces, and communities, among others, for di past week.
Dis one include: WADA enlightenment lecture to students and staff of Ansarudeen Senior High School, Saki, Oyo State; Government Secondary School, Hayin Gwarmai, Bebeji LGA, Kano; Margaret Ekpo Secondary School.
Calabar, Cross River; Agbaju Unuhu Community Secondary School, Abakaliki, Ebonyi; and WADA advocacy visit to di Emir of Lafiagi, Alhaji Muhammad Kawu Kudu, Kwara State, among others.
“While dem dey commend di officers and men of MMIA, PHPC, Apapa, Lagos, Bauchi, Ondo, and Edo Commands of di Agency for di arrests and seizures, di Chairman/Chief Executive Officer of NDLEA, Brig. Gen.
Mohamed Buba Marwa (retd), talk say dem operational successes and dose of dem compatriots across di country, especially dem balanced approach to drug supply reduction and drug demand reduction efforts, dem appreciate am well.”
NDLEA dey fight drug trafficking for Naija well-well, and dem don get plenty success recently.
For mid-July, dem stop international drug trafficking plan by seizing plenty cocaine, opioids, tramadol, and pentazocine injections.
Dem don also improve their ability to tackle drug trafficking for Naija maritime area.
For Diaspora Digital Media Updates click on Whatsapp, or Telegram. For eyewitness accounts/ reports/ articles, write to: citizenreports@diasporadigitalmedia.com. Follow us on X (Fomerly Twitter) or Facebook